Wednesday, 27 July 2016

Some kain mistakes wey fit scatter marriage and how to take korrect dem


    



 My pipul, with the way marriages dey take scatter these days hian! No be here at all o!but the good thing be sey no matter as things scatter yan reach, the two pipul wey dey inside the marriage fit still get dia levels back for each oda IF dem want make e work. For here, I go yan una the koko things wey husband and wife need to dey chook dia eye put make water for no pass garri:


*   When kpanachuku level turn low.
        Dis na one heavy mistake wey dey make marriage scatter bifor you say Jack Robinson! Plenty of the wahala wey we dey hear like when husband or wife no like each oda again, when dem begin dey far from each oda, kpanachuku for outside the marriage and some tori about divorce dey most times start from when kpanachuku level turn low. To make the marriage kajad  again, make husband and wife kontinu to dey pay special attention to dis part of the marriage no mata how long una don marry. Love wey no dey tire(unconditional love) dey importankpa if the pipul for inside marriage still want make e work. Kajad kpanachuku level also dey importankpa as e go make the bond between dem over-kajad wella wella.


*   Wound from your partina
         If you don dey inside marriage tey tey, you go know sey every marriage get im time of jolli jolli  and wahala too. Plenty pipul for inside marriage don suffer from abuse, when the man or woman dey cheat on dem, lie-lie, betrayal, dishonesty, like dat like dat. More wahala dey show face when the pipul for inside marriage go just tanda for one bad corner and dem no ready to leave dat bad corner. Look, make we yan the koko--- when something happen, e don happen be dat and nothing wey we go fit do to change am. So wetin be the next level? Na to carry the mata to Baba Godey to helep us and heal our wound from wetin any of the pesin for marriage don do you and pray make He give us the heart to dey forgive so dat bitterness no go dey our heart and dat way sef, we go fit move forward for life. Make we also remember sey nobody or marriage dey perfect.

*    Money matter
       I dey sure sey some of una wey don read reach dis level go do *Phew* E reach to do especially if na the woman dey take care of the family or the man no get job to take provide for the family. Even sef according to research, dem yan sey MONEY na the nomba one thing wey dey make marriage scatter like kilode and enter divorce level. From this money matter, you go see where husband or wife go begin hide money from each oda, dem no go dey open to demself again unto  how much dem dey collect as salary, how dem dey spend am, nobody dey give account again and bifor you know am, dem go begin dey blame each oda wey go even make dem begin dey far from each oda. Lack of respect go enter, bitterness,vexation and oda things go show face. All the same, e dey importankpa for husband and wife to agree togeda to plan how dem go take spend money for inside marriage so dat all go go wella especially for this kain economy wey evribody find demself.

*    When una no dey put ear for ground to ear each oda
        Plenty relationships for dey kajad if pipul for inside cool down and look for beta way to yan each oda wetin dey dia mind. I gree sey nobody be saint or angel, but make we try chook eye wella wella when e come to how we dey talk to our partina and our attitude when we dey do the talking. Oyibo dey call am 'body language'. Dat one serious bicos even if you no talk, your face and attitude go show wetin dey your mind. So e dey very importankpa for pipul wey dey marriage to see how dem go fit take fix time wey be sey na only dem go dey alone to fit yan beta ,true talk to demself. Make una no just yan to each oda but yan with each oda. Dem dey different. You fit talk to pesin and him or her heart no go dey with you, but when you yan with the pesin, you go see sey the pesin go hear with attention. Pipul for inside marriage must be careful of jumping to conclusion when you know even ask how e happen first, just think plenty bad things for your mind so tey your mind go begin dey replay the wrong things wey you don think sey e happen, no comot eye when your partina show wrong body language-- ask am wetin dey worry am or why he or she dey act dat way. Learn how to look pass wetin your partina dey yan and put ear for ground wella.

*   To dey far from each oda
          With the way wey things be for our world now, especially if you dey work, take care of pikin dem, handle housework, you think of how you want take make your career kajad, una go find out sey sometimes sef you no go remember sey your partina still dey one corner. plenty pipul for marriage no know each oda again as dem don allow all these things to block dia partina from dia heart and life, some no know sey na wetin dem dey do sef. Abeg, try make una run from the mistake of not to put your partina needs first from wetin he or she like to wetin him or her dreams be, how he or she dey go about how to achieve dem to wetin dey worry dem or the challenges wey dem dey face. I tell you, when una put all these things togeda, una go see how tight the bond between una go strong for inside the marriage. When these things no dey for relationship, gap go dey between the couples and to make mata worst, dem go begin dey rely and receive support and to also connect more with outsiders, especially with the opposite sex and dis dey very dangerous.Remember sey to remain connected with each oda naim be koko and we know sey e no easy but shey we get anoda way to do am? E don beta!




Photo Credit:  favim.com

1 comment: