YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Thursday, 28 July 2016
When office romance enter ONE CHANCE...
Una dey for the same company, work dey go wella and everything dey kajadly. You begin dey notice sey dat bobo or otepu dey cut eye give you anytime wey una jam each oda, weda na for the reception office or for the canteen wey una dey go chop or maybe una even dey the same department for the company, so una dey always siddon with each oda all the time and una come become friends. E no end for dia, he decide to ask you to be him babe, make una carry una friendship to the next level. You gree. Una start the romance.
Things begin dey go wella wella.Una try to put the relationship for decoding level but aproko pipul for the office still find out. Una kukuma come out begin dey show unasef. E no concern anybodi after all una be adults. Chinkili months waka pass, una begin dey get plenty quanter; he say he no do again. Una try to patch things up but e come be like sey the more una dey patch am up, the more quanter dey show face, so una decide to end the relationship. No worry! For here, make I yan you how you fit jump this level pass and still keep your head up!
Yan the matter togeda.
Yes o! Na the way to go about this break up. No matter the reason wey make una decide to end the office romance, make the two of una still siddon yan the matter wella. Make una remind each oda sey una no go want make the break up affect una performance for work. Make una dey real to unasef bicos pipul go run dia mouth for office but the koko na to make sure sey una look for easy way to take make una performance for work still dey gel.
Dey professional.
Keep your personal and work life separate.No let the break up go near your work level unless sey maybe you don get anoda job for oil company hehehe... But to dey serious, e go even make the break up dey less painful if you handle am in a professional manner, dat way aproko pipul no go too see plenty things to yan about and make you gather plenty liver to interact with your bifor bifor bobo or girlie the same way wey you go take interact with your oda koligwe dem.Carry your head up and no begin dey blame your ex- or begin dey yan pipul for office wetin happen or how e take happen. You go only dey pour more salt to injury.
Keep your distance.
Oh boy! This level no easy o but you no get any choice if you want sharperly shaperly jump this break up pass. Dem say 'Know yoursef no be curse' .E no mean sey una no go still see each oda once once for office; atleast una go jam each oda for office meetings, for una boss office if dem need una attention, like dat like dat but you fit limit how much una go meet unasef. Try to come office earlier than the normal time wey e be sey na two of una dey waka come office togeda bifor, avoid the lunch break time wey una been dey get bifor and if e dey possible, you fit invite any of your koligwe wey una parole dey kajad to join you for lunch. Warning: Make you no use anybody begin pose for your ex- especially the opposite sex or run enter anoda relationship; e go only make mata worse and you go begin dey distracted for work and if you see sey you no fit bear am again, jejeli leave the job and look for anoda place to work.
Put your mind for your work.
If e dey possible, make you marry your work and hug am wella wella. E no dey easy sha as the break up don happen but remember sey work must go on. Instead of to dey cry about and carry long face around or to dey wonder who be the next otepu or guy wey your ex- dey chook eye put for im body, put all your energy for your work. This go show your boss for office sey you dey serious with your work and when your performance for work begin dey show kajad result, e go at least make you feel beta small, if not plenty.
Carry this for mind.
Remember sey you dey spend plenty of your time for your workplace so e dey possible sey anoda office romance fit want come up but take your time to ask yoursef some quenshion weda you still get the liver to run anoda office romance parole, shey office romance for you worth am, what if e no work again( though e dey work for some pipul) but you need to take your time and think am wella wella ,weda na your way or not but whatever you decide, e dey importankpa for you to think am wella wella bifor you jump enter anoda office romance for your place of work. Shikena!
Photo Credit: huffingtonpost.com
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Thank you.
ReplyDelete