Tuesday, 5 October 2021

Signs Wey Go Show You Sey Your Partina Love You Scatter!😍

Di thing be sey if pesin love you reach dia bone, e no go hard for you to know unless sey your mind never prepare to receive di love. I go yarn you sey make you just think about di signs as sey u dey plant seed wey you want make e grow; so as you dey pour am water, sun come begin dey shine on top am and you also dey give am your care, you go see sey di seed go begin grow like play like joke. Na so too e be for love mata.


Oya make we chook eye put for di signs wey dey show sey your partina love you scatter😍

1. Your partina know wetin dey happen inside your life.

 Dis one no need long tori becos if your partina love you scatter, im go wan know wetin dey happen inside your life at every moment weda na work mata, family mata, personal mata, health mata, like dat like dat. And im go ask quenshions base on sey im wan make things dey wella for your life becos di truth be sey if all dey wella with your partina, all go dey wella with una relationship.


2. Your partina no get any wahala when e come to your success.

 Dis one dey very importankpa unto sey some love relationship don kpafuka bicos one partina inside di relationship begin dey feel one kain as di oda partina dey make correct success for im life. E no suppose be so at all. If your partina love you scatter, im no go begin feel one kain or even get any problem with your success unless sey im dey suffer from low sef-esteem(when somebodi no see imself as pesin wey fit ever do any beta thing for im life) And if you find yoursef inside relationship wey be sey your success na big wahala for your partina eye, abeg carry your slippers for hand make you jakpa from dat pesin shaperly. 


3. When your partina no dey insult you or make life be like sey na mistake you make to enter relationship with am.

One of di ways wey you go take know be sey even when una quarrel, you or im no go bring insult for di mata or even begin dey threaten una life with talk or action wey go scatter una relationship. Di sign wey go show sey your partina love you scatter be sey una dey enjoy more peace and calmness with unasef more than sey una dey quarrel and una no need to feel like sey una need to act or fake anything.


4. Your partina dey share precious moments with you.

Dis precious moments no be only when e consain bydays, anniversaries but also when e come to di everyday thing wey una dey do togeda. All dis go open your eye to show how much your partina carry you for mind reach.


5. When "thank you" be your partina way.

Na true be dis one especially when e no dey hard for your partina to say thank you for small small things wey you dey do for una relationship. E go also make plenty sense if you sef show am how much you love am so dat di love go dey ginger like sey tomorrow no dey.

When you get partina wey understand sey you need your own space inside una relationship, dat relationship go over kajad onto sey you go feel sey you get space to take grow, do wetin you wan do, meet with your paddies dem and still dey connected to your partina. Your partina go feel di same too. Dis go show sey una relationship dey on point.πŸ’ƒ❤


7. E dey always give you im support.

Yes. When you dey always get support from your partina, e show sey im love you scatter. And di true talk be sey im go be like your guardian angel wey dey always give you advice, support and even stay with you when any kasala show face inside your life.


8. Your partina dey always get time for you.

One ogbonge thing wey dey make pipul wey dey inside relationship or marriage to scatter na when dem no plan to get time for dia demsef. Too much work mata or busy busy mata na number one way to take pour sansan for inside di relationship wey dey go siriri-wererem.

Too much complain dey show sey e get mata wey still dey under carpet wey una neva still find answer to and when you get partina wey be sey im middle name na complain, na one chance you enter be dat becos dat too much complain go only dey make you or your partina feel sey you no dey appreciated or sey something dey worry you or sey your village pipul dey ontop your mata😁 and dis kain feeling no dey epp di relationship grow at all.


10. You dey always be yoursef with your partina.

Dis one no be lie! Anything wey go make you begin dey form or wan be anoda pesin for where your partina dey, no be real at all and if you come get partina wey be sey im wan change you overnight to become anoda thing or no dey make you be yoursef, abeg check dat relationship well well bifor you say  "I do-I do" and if you don enter dat kain marriage, na only God go be your helper becos nothing pass God.



Photo credit: www.lovemultiverse.com


No comments:

Post a Comment