Dis kain time wey we dey now don make courtship look like sey e no make any sense again and if we really chook eye put for dis courtship mata sef, we go see sey e get im own beta things wey e carry join bodi where e consain marriage.
Oya, as e dey hot, make I begin yarn una di beta things wey pipul wey want marry go enjoy IF dem take dia time to know each oda during courtship bifor dem enter marriage level:
1. One of the beta things wey courtship carry join bodi be sey e go involve both family members and other pipul like church pipul, and everybodi go know sey something go soon happen between the two pipul wey don enter courtship. Dis one different from when two pipul dey date bicos dating dey only involve two people and sometimes, e fit no dey public sef as courtship take be. The two pipul wey want marry go also use di opportu take know demsef well well and na parole laidis naim dey make some marriage stand gidigba for ground.
2. Anoda beta thing wey courtship carry join bodi be sey e go make everybodi from both the couple side and dia friends know sey dem don serious to take dia relationship to next level wey be marriage. So, family members and friends and church own na to give dem di support and chance wey dem need to take grow dia relationship.
3. Courtship dey also help to begin make di pipul wey want marry to begin make plans for dia future togeda. Even though sey courtship no be by fire by force mata, e go still epp dem begin take marriage mata serious and as e be courtship mata, dia family and the pipul wey dey around dem no go dey surprise when di couple finally say dem don ready to set date for dia wedding.
4. Courtship dey make pipul wey dey around di couple to know sey dia gear want enter marriage level, so when e get some kain social activities like Christmas, Easter, New Year celebrations, like dat like dat wey dia friends or family members want do, bicos dem don know di couple togeda and as dem don also know the deep level of dia relationship, dem go begin dey receive treatment as couple from family members and friends.
5. Anoda beta thing wey courtship carry join for bodi wey make am kajad be sey e dey make the two pipul wey want do "I do-I do" to begin plan how dem go take make dia life beta more more. Make e no be sey na for only moni mata abi pikin mata only but unto how dem go fit remain togeda forever and still dey keep dia love and friendship tanda gidigba even after di wedding day, and to also make dia marriage dey ginger dey go permanent site.
So for my single okpekes dem and bobos dem, e go do una correct thing if una enter courtship bifor the marriage proper as na una go still enoy di beta things wey courtship get for una. Courtship go still open una eyes to plenty things no mata how di pesin wey u enter courtship with try to hide im character and love.
PS: Abeg e go totori my belle wella if una drop una comment unto wetin una think for dis courtship mata😊
Photo credit: www.unsplash.com
No comments:
Post a Comment