Wednesday, 19 November 2014

How you fit take leave the past and move on with your life




When I say to let go of your past, e fit be when you break up with somebody wey you love wella wella or when you lose somebody wey dey very dear to you.  For you to free yourself from the past and move on  with your life, make we chook eye put for dis koko and jara wey go make am dey jejeli for you to do


1.  Make you gree sey wetin don happen don happen and you no go fit do anything to change am. Yan yourself sey you try to do your best  but e no just work.

2.  Try make you forgive yourself for wetin don happen; take am as one of the mistakes wey you don make for life.

3.   Make you watch the way you dey think. Wetin make me talk so na becos at dis time wey you dey face dis gbege, na time for you to think positively and make you no siddon on top wetin don happen.

4.   Carry for your mind sey time go heal you onto dat thing or pesin wey you don lose.

5.   Waka go out, make beta friends and joli-joli with dem. E no mean  sey make you go pack everybody  as your friend , at least make you look for few pipul wey go fit make you dey happy again. E fit be your nebo-nebo, koligwe or even pikin dem too. Play with dem and laff with dem.

6.   Remember make you also show interest for other pipul lives too bicos e go help you let go of the past patapata.

7.   Think of wetin you go fit do to make your life beta and dey kajad. If na new job you want look for, find am and if you feel sey na to pack comot from that area, abeg do am. E dey very importankpa for you to do everything  inside your power to forget and let go of your past bifor e bring you down to level zero.

8.   If e dey possible, make you volunteer your time do something  for other pipul  or for church, mosque,orphanage home,etc. Dis go really make you appreciate  life and the pipul wey dey around you,so you no go get the time to begin think of wetin don happen for your past.

No comments:

Post a Comment