Tuesday, 2 December 2014

How to make trust tight for inside your relationship





























Trust na when you believe wetin pesin yan you or you just believe sey dat pesin no go fit do you bad or anything wey go pain you, dat is to say, when you put mind on top somebodi. Efri relationship need trust to tanda kajadly kajad even when love dey totori the two pipul wey dey inside the relationship and if you want to dey run tight package with your partina or the pesin wey dey scatter your dada with love, you go need to learn how to trust dem. Oya, make we chook eye put for the koko and jara wey go help you build dat trust wey you want for inside your relationship.


*     Know yourself no be curse. Know yourself; who you be, wetin you go fit do,why you dey do the things wey you dey do, like dat like dat and make you sure sey your partina know the true pesin wey you be. Show your partina the side of you wey dey kajad and the side of you wey no too kajad. Make you no shame about am.

*    Respect yourself. E dey very importankpa. When you respect yourself as pesin, you go dey give pipul wey dey around you reasons to believe sey you go also respect dem too. Shine your eyes onto how you dey yan , act and behave to other pipul.

*    Make sure sey you do wetin you promise to do. When your partina see sey wetin you dey yan waka wella with wetin you dey do or don do, your partina go fit trust you wella wella.

*    When things begin go wrong or you notice sey things don dey yakata,make you no do like sey you no see am. Try make you see how you go fit help the mata. When you do dis , your partina go fit trust you and believe sey you go fit handle things kajadly for the relationship.

*    Give your partina beta reason why him/shim need to trust you. Make  you dey open and honest  about wetin you dey do, how your day take waka and yan about your plans for the future with am. Na our pipul yan sey pesin wey dey find friend go be like one first. Abi no be so?

*    Yan everything to unaself. No be only things wey dey importankpa una go dey yan unaself but even those things wey una think sey e no dey very importankpa. Make una no keep secret from unaself and make una learn to dey kulele with unaself.

*   For trust to dey tight for inside relationship, una go need to comot eye for somethings wey go bring kasala and even gree to wetin you been think sey you no go ever gree for. Wetin I mean be sey, for the eye of palava,learn to bend and make small shift-shift to accept your partina.
      I hope sey this koko and jara make beta sense to una. Oya, make una go use am for una relationship and make una no forget to yan me how e take waka. *Laffin tinz*

No comments:

Post a Comment