Monday, 17 November 2014

Koko & Jara for pipul wey don marry or wey just want do 'I DO I DO'




E don become common thing for pipul to yan sey marriage dey usually dey tough during the first few years bcos na the first time wey the couple go dey live togeda as man and wife plus with dia different background, upbringing, culture, tradition and things like dat but if una remember these koko and jara wey I want sunch give una for here onto how pipul wey don marry or wey dey plan to do 'I DO I DO' fit make dia marriage to dey kajadly kajad, the union go solid wella and last wella too.
Oya make we chook eye put for dis koko and jara now.


 *  The first thing wey una go put for mind be sey challenges go show face for inside the marriage and when e show face, make una no think of to kawa from am,instead make una two join hand togeda and see how una go take solve am. Challenges na normal thing for marriage.

 *   Make una learn to yan with each other and listen to each other. Make una also find older,wiser and kajad pipul wey don marry and get experience pass una to make friends with and get good advice wey go make una marriage work from dem. Make una talk-talk level dey open to each other at ALL times to take show wetin una dey feel for each other.

 *   Make una no hide una feelings but learn how to use wisdom make your husband/wife or pesin wey you want marry know wetin you need.

  *   Make una try avoid talk-talk like "You dey always..." "You  no dey ever..." instead make una dey use " I feel sey...". When una use "You no dey ever... or You dey always...", e go dey make your partina feel sey you dey judge am, but when una use " I feel sey...", e go help your man/woman want hear wetin you dey feel without the mind sey you dey judge am.

  *    If una get kwanter. ask for forgiveness directly and make your partner also forgive too. And when husband and wife dey always pray togeda, dem no go find am hard to forgive each other.

  *   For kpanashuku mata, dat one no suppose be problem bicos na the right of the two pipul wey dey inside marriage and in case any of una no dey in the mood bicos of one thing or the oda, make you let your partina know on time.
  *  Make una no ever use the 'D' word wey stand for divorce for inside una marriage no matter how your husband or wife provoke you reach bicos talk wey don comot from mouth dey be like egg wey fall for ground come break; e dey dey hard to gather dem again.

  *   Make una bring all the totori things wey una do when una been dey date enter una marriage. E go help una new marriage dey dey new everyday and also make una old marriage dey dey new too.

  *   Remember sey women need plenty of love and man need plenty of respect.

  *   Always carry for una mind sey una go live una lives togeda till una grow old.




Photo credit:    www.pinterest.com

No comments:

Post a Comment