Thursday, 19 September 2013

Wetin pride dey cause for inside relationship



      E don tey wey we don dey hear about dis word wey dem dey call pride. Wetin be dis pride sef? Pride na wen pesin begin feel sey im beta pass the pesin wey dey next to am, maybe bicos him or shim get one thing wey im feel sey the oda pesin no get. Pride na the oda side of humbleness.


     The name “PRIDE” look like sey e dey very simple, but if you look into am well well, u go see different things wey join to dis thing wey dem dey call pride sey e fit destroy  relationship whether with your husband,wife, friends, parents, children and even God sef.
         
      E get some kain bad parole wey pride dey gum put for pipul body and if  we leave am like dat, e go scatter relationship and dem be:

    *      Pride dey make pipul feel say na only dem sabi everything and wetin anoda pesin know na rubbish or e no mata at all.
       *      Pride dey make pipul be like judge over oda pipul- Everything wey any oda pesin do must get one fault or comma must dey am, Na so pipul wey get pride dey behave.
       *      Pride dey make pipul feel like sey dem dey right every time. Nothing dey wrong for anything wey dem dey do. Pipul with pride dey believe sey na their own be the best.
                                                                 








No comments:

Post a Comment