Tuesday, 6 January 2015

Koko and Jara wey go fit help your relationship grow well well


 For some pipul,when dem hear pesin say 'relationship', dia mind go first go for pipul wey dey date or pipul wey dey do courtship to take know demsef wella bifor dem marry, but I want yan una sey no bi only dis two dem dey call relationship. Marriage sef na relationship for im own level too. Na dis make me sey I go like yan una koko and jara dem wey go help your relationship grow wella wella, weda na date una dey date or una want know unasef bifor una join unasef togeda or if una don enter the marriage proper proper. So for the relationship to waka enter the next level:


*  Always put ear for ground to hear your partina.  Chook ear for the mata wey him/shim dey yan you and make you no dey too fast to yan am your advice or your own opi for the mata wey him/shim dey yan you. Sometimes, e fit be sey him/shim just want make you hear wetin dey him/her mind . Allow  wetin you go yan am in return dey natural after you don hear wetin him/shim don talk finish.

*  Look your partina for eyes when una dey talk.Stop efri thing wey you dey do and give am all your  attention.Dis level dey importankpa for inside relationship.

*  Chook eye put for the good things wey  your partina dey do more dan wetin him/shim dey do bad.Nobodi dey 100% perfect. Even you sef get your own for your bodi. And as you dey chook eye put for your partina good sides more than the bad sides, you go begin see sey him/shim go want to dey do beta things wey go dey totori your belle.

*  As human beings,all of us need somebodi to dey appreciate us even if na once once. Na so e take be for your partina side too. So, from today,begin sama plenty appreciate give your partina efri time. Dis go only make una dey kajadly close.

*  Show plenty interest for wetin your partina dey do or think.Ask am quenshun unto wetin him/shim get interest for and make you try join am for inside even though sometimes the two of una fit no get common interest. When you love somebodi, remember sey you go want  to make the pesin happy.

*  Make you and your partina try do somethings wey go bring enjoyment and sense of connection for una relationship. If na to play games togeda,no wahala. If na to baff togeda, no wahala. The koko of the mata be sey una dey do something wey dey bring una enjoyment and connect una the more.

*  To build plenty closeness and intimacy for where your partner dey, share things with your partina as e dey go with you. After all, dem say love dey sweet pass when you share things togeda.

*  Spend plenty time with your partina. Relationship dey take time, energy and maintenance to make am stay over-kajad and alive. Na when you spend time with your yori-yori, naim you go fit know wetin him/shim like and no like. So,carry go!

*  Play with your partina. Do something wey go make una laff togeda and even roll togeda for ground if e dey possible.




Photo credit:  www.ekekeee.com

2 comments:

  1. Bunor, your blog tight well well and i gbadun dis topic wey you yan so. Weldone job!

    ReplyDelete