Showing posts with label relationship. Show all posts
Showing posts with label relationship. Show all posts
Wednesday, 3 July 2019
Behaviour Wey Fit Scatter Relationship If You Don Be Careful!
My over-kajad pipul wey too gbasky, I don show face today o! Oh boy iiiieeee! E don tey o! Make una no worry. Dis one wey I don show face for blogging tinz, na forward ever titilailai.
Ehen! The mata wey I carry come una domot today na the one wey concern 'our BEHAVIOUR' for inside our relationship. Hmmm... This one na ogbonge I tell you.
Tuesday, 23 May 2017
You Ready For Mature Relationship?
Love relationship dey in different ways but all of dem need 'maturity' for dem to last. To start relationship dey very easy but to maintain am to last, na there work dey becos e go need plenty patience, understanding, to comot eye from some mistakes, and to look forward unto the future.
Make Your Long-Term Relationship Bubble
For relationship mata between man and woman, we dey get the short ones wey fit be like 3months, 6months-1year but when the relationship don dey go from 1year to like 2years, 3years, 4,5,6,7years, then the relationship don become long term be dat, and sometimes becos of the stress of the day-to-day palava, dat spark wey been dey make the relationship bubble when una start fit don dey mellow and bifor you know am, we go begin dey hear things like " he no love me again" "she no love me again", "we no love each oda again". So my kajad pipul, naim I say make I yan una how una long-term relationship fit still bubble bifor we begin hear tori wey dey touch the heart!
Thursday, 4 May 2017
How To Handle Communication Palava Inside Relationship
To dey for inside relationship wey kajad love dey exist na one of the best experience wey you go want be part of and e get sometimes when communication palava go show face for the relationship, but the koko na how una take work things out naim go either make the relationship dey successful or fall apart. And the thing be sey without open communication with each other effectively, relationship go begin dey weak. E dey really take time and work to build up relationship so no be something to rush at all and e dey take both pipul wey dey willing to put in plenty effort if dem want to make the relationship grow.
Wednesday, 3 May 2017
When Relationship Begin Get Crack
For any relationship, the good days dey and the bad days also dey too. E dey okay to experience the two sides of the relationship but when the bad side of am done come dey plenty pass the good side, then time don reach for you to begin watch out becos anything fit happen wey go begin lead to serious break up.
Friday, 28 April 2017
Coming Back Togeda After Break Up
For some pipul, to break up from relationship no be wetin dem want but for some, dem need the break up so dat dem go fit go dia separate ways for good. So my yanning for here na for those pipul wey be sey to break up no be wetin dem want, as hope still dey for una to come back, dat na IF both partners desire to come back togeda o! Oya make we chook eye put for how e fit take happen:
Wednesday, 26 April 2017
To Dey Look Popori (attractive) For Your Partner na Koko
When e come to dey look popori , na very important thing for we human beings, both men and women and; for every man and woman wey fall in love with each other, physical attraction na one out of ten things wey make dem date each other. Most times, especially when you don dey too close to your partner or you don enter marriage proper proper, this tendency go dey for you to just relax yoursef and forget yoursef so tey you no go dey worry about your looks again but e no suppose be like dat.Tuesday, 25 April 2017
Handle disappointment inside your relationship
Every relationship dey get stages and one of dem na when you begin feel disappointment unto sey some things wey you been expect to see inside your relationship or marriage no be wetin you dey see, but you go need to realise sey disappointment after you don get high hopes for the relationship na something wey you need to expect, but e no mean sey all hope don dey lost or sey you no go fit do anything. No! Hope still dey for the relationship to continue. To handle dis disappointment level when e show face, make you:
Tuesday, 22 November 2016
Reasons Why You No Need To Say 'I Do'
When e come to the level of marriage, some otepu dem go think of the part wey man and woman go yan dia promise for altar. Dem go even think go far reach where the officiating pesin go yan the two pipul make dem kiss demsef or the couple first dance or how dem go take feed demsef for the wedding reception. Dis dey totori women dem well well. But e no easy to DO the 'I do' even though e easy well well to SAY the 'I do' for altar or bifor pipul wey una invite.
Thursday, 28 July 2016
When office romance enter ONE CHANCE...
Una dey for the same company, work dey go wella and everything dey kajadly. You begin dey notice sey dat bobo or otepu dey cut eye give you anytime wey una jam each oda, weda na for the reception office or for the canteen wey una dey go chop or maybe una even dey the same department for the company, so una dey always siddon with each oda all the time and una come become friends. E no end for dia, he decide to ask you to be him babe, make una carry una friendship to the next level. You gree. Una start the romance.
Tuesday, 6 January 2015
Koko and Jara wey go fit help your relationship grow well well
For some pipul,when dem hear pesin say 'relationship', dia mind go first go for pipul wey dey date or pipul wey dey do courtship to take know demsef wella bifor dem marry, but I want yan una sey no bi only dis two dem dey call relationship. Marriage sef na relationship for im own level too. Na dis make me sey I go like yan una koko and jara dem wey go help your relationship grow wella wella, weda na date una dey date or una want know unasef bifor una join unasef togeda or if una don enter the marriage proper proper. So for the relationship to waka enter the next level:
Tuesday, 2 December 2014
How to make trust tight for inside your relationship
Trust na when you believe wetin pesin yan you or you just believe sey dat pesin no go fit do you bad or anything wey go pain you, dat is to say, when you put mind on top somebodi. Efri relationship need trust to tanda kajadly kajad even when love dey totori the two pipul wey dey inside the relationship and if you want to dey run tight package with your partina or the pesin wey dey scatter your dada with love, you go need to learn how to trust dem. Oya, make we chook eye put for the koko and jara wey go help you build dat trust wey you want for inside your relationship.
Thursday, 19 September 2013
Wetin pride dey cause for inside relationship
E don tey wey we don dey hear about dis word wey dem dey call pride. Wetin be dis pride sef? Pride na wen pesin begin feel sey im beta
pass the pesin wey dey next to am, maybe bicos him or shim get one thing wey im feel
sey the oda pesin no get. Pride na the oda side of humbleness.
Tuesday, 4 June 2013
How to reduce argument for inside relationship
If e get wetin fit make love relationship tire pesin, na argue today,argue tomorrow,argue everyday. E no mean sey two pipul for inside relationship no go argue but wetin I dey try to yan for here be sey if the argument don too much,one or the two partinas go kukuma like am make dem waka go dia separate ways. Na dis one make me want yan una wetin to do for argument to take reduce for inside relationship.
Tuesday, 7 May 2013
The sharperly ways to take scatter relationship
For dis life,we believe sey everybody get one bad side or bad sides wey gum for dia life and dis bad side fit scatter relationship wey dem dey whether na love relationship, marriage abi na just friends,and if pesin no be careful to watch am,e fit become the pesin lifestyle and dis no go dey kajad at all. Some of the bad sides wey fit spoil pesin blues with reggae na:
Subscribe to:
Posts (Atom)













