
Weekend time don come and all your girlfriends dem dey yarn you how dia weekend go be with the bobo wey dem dey relationship with but you no get bobo so you no fit follow dem yarn about how your own relationship be becos bobo no dey inside your life and bifor you know am, you go come begin dey wonder why your own case dey different from your girlfriends dem own. Hmmm... as e be so, I go dey yarn una why you as kajad babe still dey single so dat you go fit know the level wey you fall into bifor you begin say na your village pipul dey do you.
Diz na some of the reasons why some babes never get dat special bobo inside dia life:
1. When your standards over-high pass mount everest.
Now, no get me wrong. E good make babe get high standards onto the things wey she want or expect from life. E kajad well well. When babe expect make her bobo to respect her, treat her well and dey honest to her, na normal things be dat but when babe begin say 'na until the bobo wey she go like go out with or settle down with begin drive Lexus and get better salary naim she go look him side, naim be to get high standard wey pass mount everest. The truth be sey whether the bobo dey collect big salary or not no go mean sey you go find happiness or make the relationship dey kamkpe. Sometimes, the bobo fit no get all diz things wey you dey expect from am but at least if him get the mind and attitude to make am for life later, na better option wey kajad. So always ask yoursef if your standards dey real and shey your standards go get you bobo wey go make you happy?
2. When negative things na your middle name.
Shey when argument show face, you no dey want gree and you want make sure sey you win every argument? Shey you dey always dey on the defensive part? Shey you no dey ever give compliments abi na only negative words dey come your tongue or nobody dey ever please you? You need to look into this mata becos most bobo no dey like am when babes like to think negative things or show dem sey if dem no win the argument wey dey ground, nobody go win am. E dey make men run away. He no go want stay around you. Learn to open up a little and no over-stress dem with negative words.
3. When you dey go after the wrong guy.
Nothing dey bad if you go like get man wey handsome die but if na your only reason or first reason why you want dat man, OYO go be your middle name becos even the guy himsef know sey him fine die, so he himsef believe sey he fit get any babe wey him want. So my dear, make the physical look of a man no be the reason why you want enter relationship with am becos you go just kontinu dey enter one chance with guys.
4. When you no dey put ear for ground to listen.
Dis na for both men and women. Some ladies no dey get ear for listening instead na as dem want take reply naim dem dey good at. To listen to be to just hear, instead na about receiving wetin the oda pesin dey yarn you. Put ear fo ground, hear wetin him dey talk, then pay attention to body language, the tone of him voice, eye contact, know when he dey serious dey talk to you and when he just dey play and some things wey him no dey talk about but dey show am for him attitude.
5. You fit dey for the wrong area.
Sometimes, e fit be sey the kind of guy wey you go like make he date you fit no dey the area wey you dey stay or live. E fit be sey na city guy dey totori you pass and you fit connect with pass the guy wey dey your village wey dey eye you. Everybody get who dey scatter dia dada. So if na so, see how you go fit take leave dat area and go anoda area where you fit connect with the man of your dream.
6. You no dey take care of yoursef.
The truth be sey guys dey care about dis. Dem dey like am when you as a babe dey take ,kajad care of yoursef. Wear better and clean clothes, dey neat, do your hair, make up yoursef and stay in shape too. E no mean sey you no go add small flesh o but at least look presentable.
7. When your mind still dey for where your ex-bobo dey.
Tell me how you want take see anoda guy face when your mind still dey for anoda guy side. My sista, e no dey possible to settle down if you never forget your ex-bobo. Becos the truth be sey you go still dey carry feelings for am even if you come manage to enter relationship with anoda guy but you no go fit give dat guy or the new relationship 100percent attention.
8. When you dey judgemental and insecure.
Most men no dey like dey with ladies wey get dis traits. When you as a lady dey always judge people and complain about life. E go make the guy no dey free with you, so he go just waka leave you.
9. You give everything up too easily.
You meet guy today and una don sleep with each oda already. Shooooooooo! Sista mi! Wetin na? So why you want make the guy run after you again? He don see every every na. Abeg, learn to keep your cookies inside the jar and seal am up kpakam.
10. You still dey live in the past.
My sista, the earlier you begin wake up from dat your past wey wonjure you badly and dey real to life , then the beta for you. If you no do so, bitterness go become your middle name becos the more you dey visit your past, the more you go dey feel bad for wetin happen. Whether na your fault or not, abeg leave wetin don happen for past and pick up the pieces of your life and move on to anoda kajad level. You cannot come and go and kill yoursef becos things no work out as you been expect.
11. When desperation dey control your life.
The truth be sey desperation dey show for pesin face when you allow am to take over your life and when guys see am or even feel am from you, dem go want take advantage of you. So abeg, make you always dey confident of yoursef even if everybody don marry finish and you never even see bobo to hook with. Do something beta with your life wey go impact your generation positively becos , if you no know, make you know am for ontop dis blog sey e get pipul wey dey look up to you one way or the oda, so make you no go fall dia hand becos you come begin dey desperate to settle with any man.
12. You dey refuse compliments or even kindness.
To reject a compliment once once no dey wrong but when e come become every time sotey even guy tell say you fine, you turn am to quarrel, issorait o! Even if you no feel like to accept the compliment, just smile and say thank you. E no go commot anything from your body instead e fit even lead you to get the guy wey you don dey wait for. Shikena!
13. You no fit be yoursef.
Men dey dey turned off by women wey no fit dey on dia own. If man dey call you and you dey always dey with anoda man, he go feel sey you no need am and come begin wonder why he go even bother him head dey call somebody wey don dey occupied with anoda guy.
14. You no really want a relationship with a man.
Whether we like am or not, we don dey for generation wey be sey some ladies no want dey relationship with any man. Dem just want dey single by choice. If dis one na your own case, I wish you well.
Photo credit: Lifehack
No comments:
Post a Comment