YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Friday, 10 August 2018
You Dey Live Life Wey Kajad?
You don ever take your time , siddon to ask yousef weda you dey live life wey make sense? Your life dey kajad abi you just dey confused ontop how e take dey go? If your life dey go kajadly, congratulobia to you. Kontinu to add more ginger to wetin you don dey do but if you check yoursef finish and you come see sey no be as you want your life e take dey go, abeg make you no begin blame our Presido or how the kontri take affect you pass, abeg money no be evrithing. Yarn yoursef the kajad truth and the truth dem say go set you free. Oya make we how we fit epp you onto dis mata wey dey ground so.
We go start with how you go take know sey you no dey live kajad live and how you go take know sey you dey live kajad life.
SIGNS WEY SHOW SEY NO BE KAJAD LIFE YOU DEY LIVE:
* Lack of fulfilment even though sey you dey live for the biggelest, over kajad and totoricious mansion. Yes, you fit get the whole money for dis world to buy evri evri but you still get dis thing wey dey worry you for mind sey you never start to dey live di real reason why you come world.
* When you no get rest for inside your mind. Dis one different from nomba 1 becos when you finally come find out wetin your purpose for life be, you no go dey do trial and error again. Anything wey you touch go just dey go siriri-wererem.
* When you no dey touch pipul life for ways wey go also ginger dem too to do beta things for dia own life too. E no mean sey na until you hammer plenty moni or bekom one ogbonge pesin bifor you go fit touch pipul life. No! Even for dat chinkili thing wey you dey do weda na for your business, your place of work, family, house of God, your compound, like dat like dat, make e be sey pipul go fit get one beta thing to say onto how you don take epp dia life to dey kamkpe. You fit no give dem moni but bcos of how you take make dem feel or relate with dem fit turn dia life to kajad life.
* Confusion.
When confusion bekom your partner., e go slow you down like sey dis world want end now now. Make you also be careful of pipul wey be sey dem don dey confused already and dem dey look for pesin wey dem go drag follow dem into dia confused way .
* When you dey always start something all over again everytime.
Dat kind of life no dey kajad at all. You need to set time to take keep to your target or goal for life.
SIGNS WEY GO SHOW SEY YOU DEY LIVE KAJAD LIFE
* When you dey always get this strong thing for mind wey be sey you no go fit even sleep until you don do dat thing.
* When dat thing wey you dey desire make you remember experience wey you been go through bifor bifor, weda na onto good experience or bad one.
* When Baba Godey give you revelation through prayer and dreams.
*When you don know di talents, gifts and visions wey God don put inside you.
* When dis strong desire come on top your mind to do or start something. E be like passion for something wey no fit just stop like dat.
HOW YOU FIT RISE IN PURPOSE
* Put eye down to know why Baba Godey create you. When you come know the purpose, then make you accept am.
* Arrange, shine and package your purpose.
* Start to make people know wetin you dey do. You fit do am for free first, then come add chinkili money as price to wetin you dey do or you fit do am partly for money or free but make di price no too much becos na awareness you still dey create.
* Train yoursef. Tush yoursef and your purpose up. Add swagger to your purpose.
* Go for training wey dey in line with di purpose wey God don show you and grab kajad skills too. Train yoursef join.
* If you don marry, make you make sure sey balance when e come to your family and your purpose for life. Two of dem dey very importankpa.
* No ever confuse your purpose with di things wey dey trend. Guard your purpose and calling.
* Make sure sey you don tanda gidigba for ontop your main or koko purpose or talent bifor you come begin spread or enter oda business too.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment