Wednesday, 1 August 2018

How You Fit Handle Frustration










If we want dey real to oursef, we go see sey frustration na part of life. Frustration mean sey when we dey expect make some things happen as we take expect or make pipul wey dey around us or even the world to be as we want am to be but dem no come be as we want dem to be. And if we
want look am well well, true truee dey pain reach bone no be small. To add join for this frustration mata, work stress come join body plus family, relationship,money palava abi when somebody come change plans wey go come make body pepper you sotey you go come enter para level. Choi! No be here o! But anoda thing be sey frustration no go epp you at all and for am not to come overtake your life, I say make I drop dis chinkili koko and jara wey go fit epp you handle am anytime wey e want show face.






1.   First of all, try reduce the things wey you put your heart dey expect.
The truth be say plenty pipul too dey expect plenty things to work just like dat and when dem no come see things dey work as dem want am, dem go come dey disappointed. i go say make you check yoursef. Shey you dey too expect so many thing from pipul or put plenty hope in pipul? And if pipul too dey disappoint you and e dey make you dey frustrated, then you need to re-check yoursef. Find out how much pressure you dey put on yoursef, pipul wey dey around you and on the things wey dey go on inside your life.



2.   Accept life as e be.
Yes o! Somebody cannot come and go and kill himsef or hersef abeg! Just carry dis thing for the back of your mind sey from time to time, some kain things wey you no expect go happen for life. So make time for yoursef, if anything dey stand like mountain wey no want comot from your way, chook eye put inside, see how you go fit take solve and and change the situation and bifor you know am, the frustration wey for take over your life go go siddon for back seat becos you don dey take eye of solution to take look the mata.



3.   No take things too personal.
Make the things wey pipul do you or things wey happen to you vex you reach your heart becos the truth be sey as at the time wey dat pesin do you wetin you no like or wey something take happen, e fit be sey dem np plan am for you or plan to direct am to you but as e come turn around, e come be like say dem carry you for mind. Sometimes, pipul get dia reasons for the way dem dey behave, all the same, make you no take am personal.



4.   Take your time to see if the mata wey dey make you feel frustrated worth am sef.
If you see sey you want begin dey charged up with vexation over wetin happen either sey na pesin cause am abi sey e just happen naturally, look for somewhere wey dey quiet go siddon and think the mata. Shey e worth am to make you para? And even if e worth am, shey e still am for you to vex sotey all your veins go stand like wire wey electric charge? Think am well. You go find out sey even though sey the mata reach for you to vex, e still no worth am for you to frustrate your life to dat point wey be sey you go dey wonder whether na you again abi na remote control dem dey take control you.



5.   To also overcome frustration at the time wey e want show face, just take slow, deep breaths. Do am like dat for like 10 times  and you go see sey your body go begin calm down and bifor you know am, your mind go calm down too.




PS: Oya, begin waka the talk talk as I don yarn am to una and no forget to come tell me how you feel when you put all dis koko and jara to practice.








Photo credit:  The Fertile Chick

No comments:

Post a Comment