If na any of dis things wey I mention you remember, naim be sey something dey miss wey dey very importankpa and dat thing na -your vows!
And make I ask you sef-- if dem sey make you tanda again to marry the man or woman wey you dey with now, wetin go be your answer?
Your answer fit be 'No' shebi? Abi na 'Yes'?
If I say make I ask some pipul if dem remember the 'I do-I do' promise wey dem yarn each oda before the ring enter dia finger, e go choke una to know sey dem no even remember the exact words wey dem yarn each other for dat wedding day😂
So if your 'I do-I do' promise be the last thing wey come your mind, abeg wetin come be the point of all the things wey una promise each other na? You fit begin think sey na who 'I do-I do' promise epp but I tell you sey maybe if pipul begin take all the words wey dem promise demsef before Baba Godey, the man of God and dia family, e fit begin make marriage tanda wella.
Oya, make we even chook eye put for the 'I do-I do' promise wey pipul dey yarn demsef on the wedding day.
* "I do . . . wetin e mean sef?"
The first thing wey you need to know be sey your 'I do-I do' promise no get anything to do with the paper wey you sign on your wedding day. Instead na mata wey dey between you, your partina and God becos marriage no be contract but na covenant and this covenant na permanent relationship. And as our God na God of covenants and through covenants, He dey also make relationship wey go tanda with Him pipul forever.
We need to also understand sey marriage contract fit make pipul think again unto sey weda dem make the right choice abi na one-chance dem enter, and when pipul carry dis kain contract mind enter marriage, na only kasala go end the marriage.
But when pipul wey want marry or don marry understand sey dia 'I do-I do' promise na permanent promise for life, then dem go tanda gidigba for each oda when gbege of life show face becos dat 'I do-I do' promise mean sey 'I go stand by your side forever', 'I go forgive you on top any mata, 'I go be the first pesin to try make things beta for our relationship' and becos dis 'I do-I do' promise na covenant, e no only consain you and your partina, but God need to be una sure pesin too.
* "So help me, God"
"E mean sey "I need Baba Godey so dat I go fit love anoda pesin scatter sotey I no go worry my head to begin judge am". E mean sey 'without Baba Godey, our marriage no go dey special' but when we make Baba Godey our sure pesin, Himsef go make us and our marriage Him sure project too.
* "From this day forward"
But wait o! What if after all dis things wey I yarn, you still no feel kajad about your 'I do-I do' promise nko? You still dey get dat mind sey If you get anoda chance, you go do beta onto the 'I do-I do' promise wey you take on your wedding day maybe after 5 or 10 or even 20 years?
No worry your head becos the ansa to dat quenshion dey inside dis last part of your 'I do-I do' promise wey be "From This Day Forward...". Dis talk carry all the promise wey you need to always remember sey no mata wetin happen, hope still dey for you and your partina becos wetin happen before you come understand the real meaning of your 'I do-I do' promise no mata again with the epp of Baba Godey mercy and love wey no go ever fall your hand.
So if you dey feel sey life no fit be as you been think am before when you trowey eye back to look the 'I do-I do' promise wey you take with regret or you wish sey if only you fit change some kain things now, you no need to becos "From this day forward..." dey give you assurance sey all go dey well las las, and even if you feel sey nothing fit work again between you and your partina and you feel sey you no get the stamina to make the marriage work, just remember sey God get the power to make am work as long as una give am the chance to be una sure pesin.
Make you also remember sey your 'I do-I do' promise na the point wey don connect you, your partina and God togeda forever, and na your ACTION for where your partina dey naim go show everybodi, even God sey true true, you mean all the 'I do-I do' promise wey una yarn each oda on una wedding day.
So how you take take your 'I do-I do' promise go show how your marriage go last reach, if na for only 2years, 5years, 10years, 20years or forever.
Hope sey dis mata wey I drop for here make sense to una? If na so, abeg make una also drop una comment for the comment section becos I go like hear una opi ontop dis "I do-I do' mata too.😊
Photo credit: www.dailyactive.com
No comments:
Post a Comment