YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Tuesday, 9 July 2019
Know Yoursef: Sanguine aka Talk Talk
Una wehkom o my over kajd pipul. I sure sey una dey kamkpe. No shaking! Nothing dey happen. Oya na. I wehkom una again. Na anoda day to bring korrect mata come una domot and the one wey I carry come today na the one wey consain the thing wey dey control your life.
Shey you don ever siddon ask yoursef sey wetin dey really make me do some of the things wey you dey do? Your character, your attitude, the way you dey feel, how pipul dey take see you when to react to wetin dem do you, like dat like dat. For today mata, Na very long mata, so I go dey take am part one go reach paart five bcos na five dem be now. Na bifor e be four but e don increase to five after plenty chook chook of eye wey our researchers dem don do. So make you tie your oja well well to know which level you fall enter and see how you go fit take handle your own.
Number One na wetin we know as SANGUINE aka TALK TALK:
Dia Ginja Side:
This type of pipul dey like where life dey, where flenjor dey. Dem dey like make e be sey na dem dey get other vpipul attention because dem no like dull moment at all. Anywhere wey dem dey no dey dey quiet at all. Dem like to talk- dem fit talk from now go reach till thy kingdom come if nobody stop dia flow. Dem dey always look for friends well well. Dem dey like to dey happy all the time sotey you go wonder weda dem no dey ever vex. They can sabi play for the whole Africa like small pikin. Dem dey like to ginja other pipul morale. Outiside dem, you go think sey nothing dey ever move dem or make dem cry. Dem no dey like worry at all, instead dem go like to give pesin hope sey evri evri go dey kajad again.
All dis and more na the good side or make I sey the ginja side of Sanguine dem.
Oya make we chook for dia weak side too
Dia Comma Side:
Some of the things wey I go yarn now na the side wey dem come get comma. E no mean sey dem no good but na just as Baba God make dem so dat dem go fit need Him helep to control am.
Dem sabi talk too much. Plus the tori wey dem ask and the ones wey dem no ask, dem go yarn you. Dem fit also yarn small mata to look like big mata wey be sey e fit even wake dead up. Den no dey too remember pipul names, they can happy and jollificate like sey tomorrow no dey, dis energy no be here, dem fit complain too, chai! Dem can vex if any small thing happen. Na so dem also get pride too. Play play no dey leave dia corner as dem like play like no man's business. Dem no dey fit finish one thing becos dem no dey organised. Na feeling dey move dem and dem dey dey easily distracted becos of talk-talk. Dem no dey like to dey alone, dem dey forget things quick quick and make excuses too.
If you dey live with a Sanguine or you get one as friend, make you ready to increase your heardrum for talk-talk level, weda e concern am or e no concern am Shikena!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment