Showing posts with label fall out. Show all posts
Showing posts with label fall out. Show all posts

Monday, 3 June 2013

Reasons why some lovers dey fall out of love





Guy:  Baby,I love you pass my mama.The love wey I get for you no get part two. The love dey totori me sotey e dey scatter my dada and plait am join sef!Your love dey make me kolo no be small!

Babe: (laff munye-munye) Me too I love you die! Any time wey I see you,,my heart go dey do jigijigi.Your love dey make me kolo! I love you!

When some pipul fall in love,na some of the yannings wey dey enter their mind and mouth be dis. The love go dey totori dem as e dey hot. To fall in love e kajad well well but wetin I want yan for here na wetin dey make pipul fall out of love when dem don enter am.