Monday, 3 June 2013

Reasons why some lovers dey fall out of love





Guy:  Baby,I love you pass my mama.The love wey I get for you no get part two. The love dey totori me sotey e dey scatter my dada and plait am join sef!Your love dey make me kolo no be small!

Babe: (laff munye-munye) Me too I love you die! Any time wey I see you,,my heart go dey do jigijigi.Your love dey make me kolo! I love you!

When some pipul fall in love,na some of the yannings wey dey enter their mind and mouth be dis. The love go dey totori dem as e dey hot. To fall in love e kajad well well but wetin I want yan for here na wetin dey make pipul fall out of love when dem don enter am.
     Na some of the  reasons why lovers wey don become 5 and 6 bifor but come begin dey fall out of love be dis:

1.   When dem no fit gree for each oda
2.   When dem no dey sincere to each other; naim be sey dem no dey yan each other true talk
3.   When dem begin lie to each oda
4.   When dem begin dey cheat on each oda or begin chook eye for outside for where anoda man or woman dey.
5    When dem no get respect for each oda again
6.   When one of dem or the two of dem don get anoda thing wey carry dia mind comot from dia partina like new job,newborn baby,ogbonge project,like dat like dat.
7.   When dat thing wey been dey totori dem(romance) don mellow
8.   When one partina change him or her ways or character for where the oda pesin dey.Pipul dey change as relationship dey grow and the changes fit make you wonder and begin feel like sey you no dey exist especially when e no be on the good side but on the bad side.
9.   Anoda one too na when the two pipul love each oda  bicos of the way the oda pesin look or dey talk,laff or e fit be sey he/she think sey the oda pesin over perfect. The moment dis kain 'love' wash comot from dia eyes,dem go begin notice sey dem no too get anything in common and bifor you know am,kwanter go begin enter the relationship.






No comments:

Post a Comment