Tuesday, 30 April 2013

Koko and Jara for pipul wey just enter new relationship


















When pesin just enter new relationship with a new guy or new babe, e dey shack like stuff as Stan Iyke take talk am and if you no be careful unto how to handle your feelings as e dey do you, you fit begin dey lose dat pesin small small.So therefore make we chook eye put for dis koko and jara wey go help you to maintain the new relationship wey you just enter make you for no miss road.

For guys wey dey shy: Wetin to do to take toast or chaik dat babe to be your otepu *Winks*





For some guys,when e come to the level of toasting or chaiking babe,na serious exam e dey be for them and where water go come pass garri na when the guy himsef na shy pesin. E no dey dey funny at all but as guy,you no need to open eyes for night dey count how many slate dem take do your ceiling again. Make you follow these steps one by each to help your ministry move to permanent site.

Monday, 29 April 2013

How you fit build kajad-closeness with your yori-yori

When I dey talk about kajad-closeness for inside relationship with your yori-yori, na dat type of relationship wey be sey nothing dey shake am at all no mata wetin dey happen bicos of some things wey the two pipul wey dey inside the relationship don learn to do togeda and e kom make dem be like 5 and 6. Like play like play, notin fit come between dem and for you wey be sey dis kain of relationship dey totori you and hungry you to do,follow dis koko and jara for here.

How you fit comot bitterness from your mind




To carry bitterness for mind na one quick way to kaput comot from dis world and anybody wey dey always carry bitterness for mind no dey ever happy bcos as e never forgive the pesin wey do am wrong,anytime wey e remember the mata,vex go catch am and one thing wey pipul no understand be sey when you carry bitterness for mind bcos of wetin anoda pesin do you,you dey give the pesin  power to rule your life.But when you comot bitterness from your mind and allow forgiveness to enter your mind,you go dey joli-joli your life dey go.So for you to fit comot bitterness from your mind sharp sharp,make you chook eye put for dis koko and jara.