YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Tuesday, 30 April 2013
For guys wey dey shy: Wetin to do to take toast or chaik dat babe to be your otepu *Winks*
For some guys,when e come to the level of toasting or chaiking babe,na serious exam e dey be for them and where water go come pass garri na when the guy himsef na shy pesin. E no dey dey funny at all but as guy,you no need to open eyes for night dey count how many slate dem take do your ceiling again. Make you follow these steps one by each to help your ministry move to permanent site.
1. Approach the babe wey dey totori you.
You fit start with 'Hello' or 'Hi' or you fit give am some nice compliment like 'I like the dress wey you wear' or if na her hair fine,compliment her too but at the same time e dey importankpa for you make you no over-do the compliment so thatsh e no go begin look like sey you dey lie.
2. Make you try catch her interest.
Eye contact dey very importankpa if you want catch her interest.Look her for face when you dey yan am wetin you carry for mind and abeg no try to begin look her body,maybe from head to toe bicos e go look like sey you dey price her and dis fit no go down wella with her.
3. Help am out.
If e get wetin she dey do or sey she carry something,dis na also the time for you to show your swag; try help her out and if she no gree make you help her,wait until she really need your help.Make you still continue to dey friendly and outgoing too.
4. Time to ask her the kwenshun.
And wetin be the kwenshun?Naim be the reason,the koko why you dey try to dey close to her all dis time: 'You go fit be my girlfriend or e go sweet me if you go be my girlfriend? When you ask her finish,make you wait for her to give you answer.
5. Make you no start to dey para if she sey 'No'.
E fit happen like dat. If she say 'Yes', let her know how happy you dey and if na 'No' be her answer,make you no para . E fit be sey e get anoda pesin wey she get eye for and if no be so, e fit be sey she see you just as friend and nothing more.Make you no try to force her or begin dey make her feel guilty about the whole thing.
Photo credit: db2.stb.s-msn.com
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
konfirm one bruno. I be shy guy o but I don woo couple of girls b4. Na inferiority complex dey cause am sumtimes sha
ReplyDeleteThan you Uche Frank. I happy sey you no allow inferiority complex knock you for ground. More muscle to you. :)
Delete