
1. Make you and your partina dey yan each other about everything.
2. Make you dey dia for your partina when him/shim need somebody to yan wetin dey worry am for mind.
3. Make you dey reliable especially when your partner need somebody to count on.No be when him/shim need you,e no go see your breaklight; e no go make sense at all especially when you sey you dey for inside love relationship with dat pesin.
4. Make una get many common things we una dey do togeda.Like if na to play games togeda,cook togeda abi to baff together.When una dey do things togeda,e go make una closeness kajad wella wella.
5. Accept your partina for who him/she be.No try to change am.No be small pikin he/she be wey you fit begin train.
6. Make you listen to your partina opinion as him/her own opinion dey as important as your own dey too.
7.Make sure sey you dey always chook eye put for wetin concern your partina good.Naim be sey anything wey you hear sey e go fit spoil him image for anywhere,defend am first even if that thing wey you hear na true and when una come dey together where anoda pesin no dey,make you start to yan am the things wey you no like about wetin him/shim do.
8. Make your shoulder always dey ever ready to lean on when he/she need to cry.
Photo credit: www.areureallyawake.com
No comments:
Post a Comment