Tuesday, 30 April 2013

Koko and Jara for pipul wey just enter new relationship


















When pesin just enter new relationship with a new guy or new babe, e dey shack like stuff as Stan Iyke take talk am and if you no be careful unto how to handle your feelings as e dey do you, you fit begin dey lose dat pesin small small.So therefore make we chook eye put for dis koko and jara wey go help you to maintain the new relationship wey you just enter make you for no miss road.

1.    No ever believe quick quick  sey dat pesin wey you just start relationship with na your soul mate(whether una just meet or una don start the relationship )Take your time  to know the pesin wella wella.

2.     No tell everything about your life to your new partina sharp sharp bcos e go dey too early especially when e be sey you just dey know the pesin new new.

3.     Try to acknowledge the things wey no rhyme with you and your partina values,lifestyle and belief.Yes,na the time for wetin dem dey call 'reality check' be dis.As two pipul wey just start new relationship, una go get wetin una like and things wey una no like plus una different backgrounds and e fit be sey your partina na pesin wey dey talk too much or pesin wey too dey forget things,like dat like dat.

4.    If you notice sey you no like your new partina behaviour  or some kain attitude wey him/shim get, make you let am know so that him/shim go know wetin you fit accept and wetin you no fit accept and una fit begin try dey make small small adjustment.

5.    No ever demand or beg for attention from am for that early stage.You go only succeed to push am comot from your side. Give yoursef and your partina some kain  breathing space so dat the relationship go fit grow.

6.    Make you no play games. Try to dey honest and when I say honest,I no mean make you go dey yan all the bad bad things wey you get for your past especially on the first date.Wetin I mean be sey make you talk about your goals,priorities,intentions,desires, as e dey go.

7.    You need to practice the habit of to let go; e fit be for your past relationship. You need to forget about the experience wey you get from your past relationship wey no work so that you no go carry the bad belle wey you get for your former partina enter the new relationship.

8.    If  long-term  relationship with dis new guy/babe dey your heart, you go need to dey patient,kind,ready to listen,ready to truly forgive,ready to bend when e come to some kain mata and other things too.

9.    As time come dey go on for inside the relationship, make you and your partina begin dey yan each other about how una take  grow up and e go even good sef if una share childhood memories with each other. E go draw una closer and faster than as una take expect the relationship to grow.

10.   No compare your new partina with other pipul or your former boyfriend/girlfriend.Na to kill the relationship be dat one time. 






Photo credit:  www.singleblackmale.org


No comments:

Post a Comment