Monday, 29 April 2013

How you fit comot bitterness from your mind




To carry bitterness for mind na one quick way to kaput comot from dis world and anybody wey dey always carry bitterness for mind no dey ever happy bcos as e never forgive the pesin wey do am wrong,anytime wey e remember the mata,vex go catch am and one thing wey pipul no understand be sey when you carry bitterness for mind bcos of wetin anoda pesin do you,you dey give the pesin  power to rule your life.But when you comot bitterness from your mind and allow forgiveness to enter your mind,you go dey joli-joli your life dey go.So for you to fit comot bitterness from your mind sharp sharp,make you chook eye put for dis koko and jara.


1.   First of all,make you dey sure sey you want comot the bitterness from your mind.
      If you still dey carry bitterness for your mind,e go carry all your energy run,scatter your peace of mind and even make you lean sef so tey pipul go dey wonder whether you dey sick  abi you get problem and  bifor you know am,body go begin dey pepper you for any small thing wey just happen.So you need to make up your mind sey you want comot bitterness from your mind if only you yan yoursef sey true-true you carry bitterness for mind.

2.  Write down all the bitterness wey you carry for mind against the pesin.
     Carry paper make you write down all the things wey the pesin don do you wey make bitterness enter your mind.Make you dey real to yoursef and no pretend at all.Dey honest to yoursef and when you don write am finish,make you tear the paper or burn am with fire.This na the step wey you dey take to yan yoursef sey you don dey put am for practice how to forgive the pesin wey do you wrong

3.   Put your mind for anoda thing wey make sense.
       E no matter wetin cause the bitterness bcos if you continue to dey give excuses why you no fit forgive the pesin wey make you dey para so tey you carry bitterness against that pesin,na yoursef you dey do.So e go beta for you if you just comot your mind from the bitterness and put your mind for something wey go make your life dey kajad and happy.

4.   Make you no dey look for perfection from anybody or from yoursef.
      Nobody dey perfect and everybody dey make mistakes and you sef join too bcos you no dey perfect too.The koko of the mata be sey make you no expect too much from people and make you dey kind to yoursef.

5.   Make you get heart wey dey quick to forgive.
      No matter wetin cause the bitterness whether the thing baaaaaaad abi e pain you like when dem pour salt on top wound,the mata for ground na to use your hand rub your chest and forgive the pesin.I no sey e no easy but to forgive the pesin na for your own good.

6.  Make you dey dey grateful.
     Begin dey look for one thing wey you dey grateful about everyday and leave bad things alone.Start to dey do am one by each small small until you go don gather plenty things wey be sey when you look back,you go nod your head and yan sey 'I dey grateful'.



Photo credit: www.madamenoire.com




----------------------------------------------------------------------------------------------------------------------------

Disclaimer: 
Comments And Opinions on Any Part of This blog Are Opinions of the Blog Commenters or Anonymous Persons and They Do Not Represent the Opinion of BunorWorldEmpire.blogspot.com.ng

Pictures posted on this site are given credit and if a picture is yours but credited to the wrong source, please contact BunorWorldEmpire.blogspot.com.ng and corrections will be made.

If you have a complaint or a story, please contact BunorWorldEmpire's Blog via

Bunor28@gmail.com
Mobile Phone: +2348050595034



6 comments:

  1. Na true talk una don yarn. Pesin wey wan commit bitterness no go dey look for perfection and e must dey grateful.

    ReplyDelete
  2. Dis write up make sense die. Weldone Bunor

    ReplyDelete
  3. Na true talk u don yarn so. if we commot bitterness e go help our own state of mind

    ReplyDelete