Men and women get different ways wey dem dey take yan, different things wey dem need and desire plus different challenges wey dem dey face inside relationship.The way man dey take things dey different from the way woman dey take things and as woman,e get some kain things wey you go need to do and no do if you want make your man dey joli-joli your parole for una relationship as e dey move enter future level.
* When you want spend kajad time with your man, make you try to dey positive for your attitude. No be sey any time wey you dey with am, na so so from one gbege enter anoda one you go dey yan am.Yes,time dey for that one but at least make him still see and feel sey everything about you no be wahala mata all the time wey una plan to dey togeda.
* Make you dey show and yan am how much you appreciate any little thing wey him dey do just to make you happy.Learn to say 'Thank you dear' 'I love you for how you just dey take care of me'.
* Ask for wetin you want. No mata how your man love you reach, he no go fit read your mind to know wetin you want; so na you go use your mouth yan am wetin you want. Even the bible talk am sey make we ask and we go receive.
* When your man say 'No' especially when you ask am for something,just free am even if the answer no make you happy.Trust your man enough to know sey if him fit do wetin you ask am for,he go do am for you.
No do dis:
* No try to begin yan mata with your man when him dey try to watch one beta movie abi any sport show like football.Wait until after he don watch am finish bicos most men no dey like joke with that kain thing especially when he get to do with sports.Learn to know the right time to bring mata up wey you want yan with am.
* No talk to your man like sey you dey talk to small pikin. Remember sey na adult him be,so give am the respect wey be him own.
* No ever use kpanashuku as something to use pay am back for anything wey him do to you wey you no like. E no go dey kajad at all bicos na the way wey you go take give invite to palaver wey just siddon him own to enter una relationship be dat and at the same time, make you no also use kpanashuku as reward for any good wey him do for you .
* No compare am with other men. Dis dey pain men well well bicos he go make dem feel like sey him no good for you or sey he no dey enough to satisfy you.
* No disturb him privacy if him want dey on him own for some time. Remember sey him get him own life too to think of.
* No try to change am. Just take am as him be. If you dey try to change your man from who him be to wetin him no be,wahala go dey flow every time for inside una relationship.
Photo credit: http//www.relationship.freshgists.com
my sister u talk well
ReplyDeleteThank you Nwabunor Obiomah. :)
ReplyDelete