Saturday, 4 May 2013

Koko and Jara to take protect your pikins from bad belle people onto illegal torchliting of pikin website





The mata of illegal torchliting of pikin  website no be mata wey dey new again as e don turn to everyday parole for the kain world wey we dey now. Dem say 'knowledge na power', so make parents  start to dey teach dia pikin wetin to do when dem notice some kain thing wey dey happen around dem.


1.   Make parents try to teach dia pikin how Baba Godey take make dia body. 
      Make dem know sey every part of dia body good,but e get the parts wey pipul suppose see  and the parts wey some pipul no suppose see unless when dem go hospital  or if you as dia parents want baff or wear dem cloth and make you as parents go on to show dem the parts wey be dia public parts (like dia head,hand,leg,nose,ear,neck) and dia private parts(like dia breast,virgina,penis and dia mouth too) Now una go dey wonder sey why I add mouth to the list of private parts.The reason be sey some of our parents dey make the mistake of to dey kiss dia pikin for mouth instead of  for dia cheek.When anybody wey want do dem bad thing come give dem kiss for dia mouth,the pikin go take am sey na so mommy and daddy dey kiss me too.Make una teach una pikin sey to kiss for mouth na for papa and mama only.


2.      Make parents teach dia pikin the right name of dia private body parts. 
         Parents,make una no dey use names like bombom for dia buttocks,jogbojogbo for dia penis, like dat like dat. At first,e fit no dey easy to begin yan dem the real name of dia private body parts  but as time dey go ,e go help dem to fit report to una when somebody want touch those parts of dia body.


3.     Let your pikin know which one be good touch and the one wey be bad touch. Make dem know when somebody dey touch dem for places wey dem no like whether na family pipul abi na friends or any other pesin..Teach dem to say 'I go tell  my mommy and daddy'.


4.      Make parents allow dia pikins to dey free to yan dem anything.
Make una be una pikin  bestest friends as dis one go help dem to fit yan una anything when somebody want touch dem where dem no like at all.Let dem know sey una no go beat dem if dem report instead una go dey proud of dem sey dem open dia mouth to yan you wetin pesin dey do dem.


5.     Carry your pikins siddon and teach dem who you want dem to trust so that when some kain pesin try to do dem any yamayama thing,dem go fit report to either you or those pipul wey you dey kajad sure of.


6.       Teach your pikin the difference between secret and surprise even though dem start with the same letter 'S'. Teach dem to know sey surprise na something wey dey bring happiness and when everybody finally see am,dem go happy too but secret na when dem do something where other pipul no dey to see dem  and come yan dem sey make dem no tell anybody about wetin dem do; especially when the pesin sey make e just be between the two of them only,even sef make mommy and daddy no know about am.


7.      Parents need to report to the right pipul wey dey chook eye for mata wey concern touchliting of pikin website.We get plenty NGOs for all corner now. Remember sey the world dey suffer plenty now,no be bicos of the bad thing wey bad belle pipul dey do but na bicos the good pipul kpichikum dia mouth, dat one mean sey dem keep quite about the mata.


8.     Make una dey always pray for dem anywhere wey una dey bicos na only Baba Godey dey see every every.At the same time make una do una bestest best as parents to protect una pikin dem and leave the rest for Baba Godey to do.










No comments:

Post a Comment