Sometimes,some men dey complain say dem no know wetin dem go do for dia woman to flow with dem bicos e dey be like sey nothing wey dem dey do wey dey satisfy dem. So na dis make me sey make I write down some of the things wey men go need to do and wetin dem no need to do inside relationship to take satisfy dia woman.
Do dis:
1. Listen to your woman when she dey talk about something wey dey bother am for mind but no give am advice until she ask for am. Some men dey make dis mistake when dia woman carry some kain matter to yan dem.For some of the mata,dem just want yan you dia mind as e dey do dem, no be to look for advice unless sey dem need am,dem go come ask you sey wetin you think about am;if not, just put ear for ground and listen to her.
2. Respect any agreement wey you get with her or wey u don make with her.No be when you don agree on something with her finish,the next moment you begin dey do your own thing. E no go too jell with her at all.
3. Try treat her as equal partina for inside the relationship and no be as 'Oga and servant' level.
4. Make you dey give her morale onto wetin concern her goals,visions and dreams of wetin she go like to achieve for life.
5. Learn to say 'I dey sorry' when you don do something wey vex her; whether you know-know do am or not.Just say u dey sorry and make you mean am too.
No do dis:
1. No pretend to dey listen to her mata when you know sey your mind dey anoda place or anoda thing.She go notice and dis one go make her para.
2. No talk bad about her especially the way she look.Na to kpafuka her morale be dat.
3. No go begin sleep when you no sey you and your woman don get quanter wey una never settle.
4. No shout for her like sey you be her papa.No be small pikin she be. E no go jell at all.
5. No forget special occasions like her birthday,wedding anniversary. In short,any occasion wey dey totori her, abeg make you try your bestest best to remind her just to make her know sey she still be the only one wey occupy your heart.
good one
ReplyDeleteThank you Anonymous. I appreciate your comment. :)
DeleteThank you Matt Feuter. :)
ReplyDelete