Tuesday, 7 May 2013

The sharperly ways to take scatter relationship
















For dis life,we believe sey everybody get one bad side or bad sides wey gum for dia life and dis bad side fit  scatter relationship wey dem dey  whether na love relationship, marriage abi na just friends,and if pesin no be careful to watch am,e fit become the pesin lifestyle and dis no go dey kajad at all. Some of the bad sides wey fit spoil pesin blues with reggae na:

 *      When you dey always keep record of wetin don happen for a long time. You no dey fit forgive when pesin or even your partina  do you wrong;and when any small quanter show face,you go bring wetin don happen tey-tey for the mata wey dey ground.

*      When you dey always show power with your partner or pipul wey dey close to you. If na pipul wey dey far or wey you dey do business with,dat one dey different but when e come to the pipul wey dey close to you,dat one no kajad at all.

*     When you dey always find fault for other pipul life. As you dey do dis,wetin you dey yan pipul be sey you dey perfect and na lie be dat. If you love somebody,even if him/shim get im own for body, you go comot eye from him/her fault and love am like dat.

*     You dey always want prove sey you dey right about everything even when e no dey importankpa to prove am,but make you just show sey na your right or sey you too sabi. No forget sey sometimes when you want make peace dey for inside your relationship,you go need to leave dog wey don lie down to sleep.

*     When you turn yourself to street-fighter for any small argument wey you get with your partina or pipul or use words wey go pain the other pesin reach bone.

*     When you dey always look for attention all the time.Most pipul no like am when the pipul wey dey around dem dey too chook eye for who go give dem attention twenty-four/seven bicos dem sef get dia own life to live too.Dis kain thing go put pesin for bad corner especially for inside love relationship with him/her partina.

*    When you feel too relaxed. No swag.When you no fit contribute beta thing for your partina life or the pipul wey dey around you or even ginger dem with your life. 

2 comments: