Tuesday, 4 June 2013

How to reduce argument for inside relationship





 If e get wetin fit make love relationship tire pesin, na argue today,argue tomorrow,argue everyday. E no mean sey two pipul for inside relationship no go argue but wetin I dey try to yan for here be sey if the argument don too much,one or the two partinas go kukuma like am make dem waka go dia separate ways. Na dis one make me want yan una wetin to do for argument to take reduce for inside relationship.


Ways to take reduce am na:

*    No argue  bcos talk dey totori you. E get pipul wey be sey to argue with dia partina or pipul dey give dem morale.For dat kain level,dem be champion and dem go want show sey dem sabi talk and bifor you know am,argument don enter anoda level be dat and yawa go come gas.
*    Take your time to listen to your partina instead of to dey talk when him/shim dey talk.
*    Say you dey sorry if you fit just to make the argument die if you see sey e want  start
*    Remember sey una be one,so una no need argument to show una swag
*    Stop to try to chook eye onto who go win the argument.E no go help the relationship to joli-joli at all
*    No turn the small argument wey una don get to become personal issue.Carry am comot for mind bifor e begin make you think wetin you no suppose think of.
*    Chook your ears for ground more and no allow your mouth drive rough.Dis go help una relationship well well.
*    Make you get patience for where your partina dey.
*    Wear tolerance as garment for where your partina dey.Remember sey him/shim no dey perfect.
*    Carry your maturity enter the mata wey dey ground even if your partina no want hear your side.When everything don mellow,make you come yan am your own side.
*    Make una communicate like adult wey respect and love each oda.

No comments:

Post a Comment