YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Tuesday, 22 November 2016
Reasons Why You No Need To Say 'I Do'
When e come to the level of marriage, some otepu dem go think of the part wey man and woman go yan dia promise for altar. Dem go even think go far reach where the officiating pesin go yan the two pipul make dem kiss demsef or the couple first dance or how dem go take feed demsef for the wedding reception. Dis dey totori women dem well well. But e no easy to DO the 'I do' even though e easy well well to SAY the 'I do' for altar or bifor pipul wey una invite.
Thursday, 28 July 2016
When office romance enter ONE CHANCE...
Una dey for the same company, work dey go wella and everything dey kajadly. You begin dey notice sey dat bobo or otepu dey cut eye give you anytime wey una jam each oda, weda na for the reception office or for the canteen wey una dey go chop or maybe una even dey the same department for the company, so una dey always siddon with each oda all the time and una come become friends. E no end for dia, he decide to ask you to be him babe, make una carry una friendship to the next level. You gree. Una start the romance.
Wednesday, 27 July 2016
Some kain mistakes wey fit scatter marriage and how to take korrect dem
My pipul, with the way marriages dey take scatter these days hian! No be here at all o!but the good thing be sey no matter as things scatter yan reach, the two pipul wey dey inside the marriage fit still get dia levels back for each oda IF dem want make e work. For here, I go yan una the koko things wey husband and wife need to dey chook dia eye put make water for no pass garri:
Wednesday, 9 March 2016
Koko and Jara on top relationship and marriage mata don show face again!
Wow! It's really been a looooong time I came here to write, though I've been scrolling through every now and then, strategizing on what and what to add to make my awesome readers enjoy and stay glued to this page, but make una no worry my splunfik pipul. I go begin dey sunch una beta and kajad koko and jara on top relationship and marriage mata wey go helep una enjoy una relationship and marriage. Make una carry chair siddon close by! Una gudu morning!
Subscribe to:
Posts (Atom)