Tuesday, 22 November 2016

Reasons Why You No Need To Say 'I Do'






When e come to the level of marriage, some otepu dem go think of the part wey man and woman go yan dia promise for altar. Dem go even think go far reach where the officiating pesin go yan the two pipul make dem kiss demsef or the couple first dance or how dem go take feed demsef for the wedding reception. Dis dey totori women dem well well. But e no easy to DO the 'I do' even though e easy well well to SAY the 'I do' for altar or bifor pipul wey una invite.

       Wetin dis word 'I Do' mean be say you go love and remain kakaraka with the pesin wey you say 'I Do' to no mata the condition, weda he/she do good or bad. When una marry finish, everyday wey una begin live togeda,test to prove the word 'I Do' go begin show face like play like joke. Dis na why we you must think and reason am well well and ask yoursef plenty queshions bifor you yan dat broda or sista 'I Do'. Ask youresf:


1.   Shey him/she be my friend?
   First ask yoursef and find out for yoursef if him/she be your friend becos the pesin wey you suppose marry must be your friend first of all as marriage get to do with oneness, dat is to say una go be one for everything wey una want do inside the marriage.

2.  Shey him/she get the fear of Baba Godey for him/her heart?
    Pesin wey no get dis kind fear of Baba Godey no go fit get kajad wisdom to take rule and lead una to where Baba Godey want lead una go. Man wey get dis fear of Baba Godey go know sey Jesus Christ na him oga and he go honour and treat him wife well well for the role wey Baba Godey don call am to play inside the man life, na so e take be for the woman wey get the fear of Baba Godey. God go direct am unto how she go take respect and hear her husband word.

3.   Shey him/her character match your own?
    For you to dey sure of the type of man or woman wey you want marry, you must know your own  character/temperament and you must also know the side wey you dey strong and where you dey weak becos dis go helep una complement each oda well well.

4.    Shey na pesin wey you fit trust anytime anyday?
      Trust na two ways o! First of all, how far you go fit trust dat man or woman wey you want marry? Trust na very important matter when e come to relationship. So you need to dey sure sey you fit trust dat man to fit control himsef for where women,drink,decision-making,peer pressure,etc dey and sey he no go fall if women surround am, and e also dey importankpa for you wey be woman to trust your man as e also dey importankpa for am to trust you too. You need to marry man/woman wey love you for who you be and wey trust you. You also need to marry man/woman wey go give you freedom/your own space to do your own thing as long as no be to cheat on the oda pesin.

5.   Shey una religious value na the same?
    Dis one na the koko. No go tie yoursef togeda with pesin wey you no dey connected with spiritually all becos of passion and emotion as dem dey yan sey "na the spiritual dey control the physical". Na the woman naim go suffer for dis one becos she no go get any oda choice than to follow her husband do wetin him dey do make peace and unity for reign but she go dey die inside the marriage small small.

6.   Shey una dey intellectually balanced?
      If we want look am, dis one no suppose be serious mata for inside marriage except say some men no dey feel comfortable when dia wife read book pass dem. But me I go say if dis one go cause wahala, make the man kukuma tush up himsef unto adult education so that he go fit meet up to him wife level or make the woman tush up too unto adult education so dat she go fit meet up to her husband level too.

7.  Shey una dey attracted to each oda?
    Physical attraction na one of the things wey dey keep man and woman attracted to each oda. Something must dey wey dey keep dem togeda even after dia first totori of the new relationship or new marriage don waka go.




 Photo Credit:   Citifmonline.com

No comments:

Post a Comment