Tuesday, 25 April 2017

Handle disappointment inside your relationship








 Every relationship dey get stages and one of dem na when  you begin feel disappointment unto sey some things wey you been expect to see inside your relationship or marriage no be wetin you dey see, but you go need to realise sey disappointment after you don get high hopes for the relationship na something wey you need to expect, but e no mean sey all hope don dey lost or sey you no go fit do anything. No! Hope still dey for the relationship to continue. To handle dis disappointment level when e show face, make you: 



*  Recognize the disappointment first of all.
Try to dey honest with yoursef and yan yoursef how you feel about the feeling of disappointment wey you dey feel as things no dey go as you been expect.

*  Try understand am and know where dis feeling of disappointment dey come from. Shey na becos you don too expect too much from your patina, so as he/she no dey do according to how you don plan everything for your mind, you feel disappointed? or maybe you been think sey things go work out just as you take dey see for movies or romance book wey you don read?

*  Stay positive when e come to your reaction and the things wey you been dey expect. E dey easy to allow your reaction to turn to vexation but I tell you no be wetin you need, instead try see how you fit turn your disappointment into positive thinking. Yan yoursef sey things go work out fine and sey hope still dey.

*  Stay hopeful. One of the best ways to take handle dis kain matter of disappointment inside your relationship na for you to know sey dis diasappointment no go dey permanent. E go disappear very soon.

*  Yan how you dey feel with your patina the way wey he/she go take see how you dey feel and understand you well well.




Photo Credit:  www.gabrielsreport.com




No comments:

Post a Comment