Friday, 28 April 2017

How To Waka With Pesin Wey Dey Dey Moody






 Sometimes, you fit notice sey some pipul around you or your friends dey dey moody for no reason and you fit no understand why or how you go take relate with dem. My pipul na serious gbege o!especially when e be sey no be you cause wetin dey make dem feel moody at dat point in time. Shoo! E no dey easy o!but instead wey you go leave dem waka comot or begin quarrel with dem, make you try to do dis things:




*    Ask am if everything dey alright and if e get wetin  him/she go like talk to you about. E fit be sey e get wetin you don do wey dey make am para, so if you ask am, e fit open up to you but make you ask am gently.

*   Anoda one be sey when you ask am and you see sey he/she no want talk, abeg respect him/her wish if he/she no want talk becos if you begin push or try to force am to talk, e fit make mata worse o! and I tell, dat one no go gel at all.

*   When the pesin come decide or make up dia mind to talk, abeg stop anything wey you dey do and give am all your attention and put your ear for ground to hear wetin e want yan. For most pipul wey dey dey moody, when dem open up to you, dem go dey relieved sey you get dia time to listen to dem and e go totori dem well well.

*   For some cases, moody pipul fit want need some space to demsef alone, no be sey becos dem no want share wetin dey worry dem for mind, but becos dem just need some space to do some positive thinking. Abeg, respect dia decision if dem want dey alone.

*   Anoda thing wey you go fit do to help your friend/partner na to take dem out, maybe una fit waka go watch movie, play games, waka around una environment, go jog or go visit una oda friends dem just to make am come out of him/her moody life.

*   The last one be sey make you try not to judge your friend/partner or begin hammer am words wey no kajad when e dey him/her moody state. I tell you, e go too spoil things biiiiiiiiiiiiiiig time.







Photo credit:    Pinterest

No comments:

Post a Comment