YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Wednesday, 26 April 2017
To Dey Look Popori (attractive) For Your Partner na Koko
When e come to dey look popori , na very important thing for we human beings, both men and women and; for every man and woman wey fall in love with each other, physical attraction na one out of ten things wey make dem date each other. Most times, especially when you don dey too close to your partner or you don enter marriage proper proper, this tendency go dey for you to just relax yoursef and forget yoursef so tey you no go dey worry about your looks again but e no suppose be like dat.
* Take care of your body.
Your physical appearance matter to the pesin wey you dey inside relationship or marriage with.. Stay healthy, watch wetin you dey chop, take care of your weight, do exercise and make you sleep well well.
* Practice good hygiene.
Baff always, brush your teeth, shave the necessary places for your body wey hair full. Make your body dey smell good all the time atleast for the sake of your partner so that he/she no go dey run from you becos of body or mouth odour.
* Put extra effort where e concern your appearance. Make up, wear perfume, wear beta clothes wey go dey attract your man or woman, like dat like dat.
* Honour wetin your partner ask of you to do for am as long as sey the thing wey he/she ask for no be wetin go make you dey or feel uncomfortable.
* Stop habits wey dey vex your partner.
To leave the room when you want mess, to close your mouth when you dey chew gum or yawn, to scratch your private parts for private and no be for public and do some other things wey be sey normally you go fit do am when you dey alone, go help you look popori bifor your partner.
Photo credit: The Huffington Post
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment