Friday, 28 April 2017

Coming Back Togeda After Break Up





For some pipul, to break up from relationship no be wetin dem want but for some, dem need the break up so dat dem go fit go dia separate ways for good. So my yanning for here na for those pipul wey be sey to break up no be wetin dem want, as hope still dey for una to come back, dat na IF both partners desire to come back togeda o! Oya make we chook eye put for how e fit take happen:






*   Take your time to find out wetin cause the break up in the first place becos the truth be sey the relationship break up for a reason or some reasons.Maybe you no appreciate the little things wey your partner dey do for you or maybe you dey take your partner for granted or maybe sef na becos you don get anoda pesin wey been dey totori you apart from your partner. Whatever the reasons be, take some time find out why the relationship break up in the first place.

*   Make commitment to see sey the relationship work for better. 
You no fit change wetin don happen as e don pass but you fit change the future. When you love and care about somebody, you go pick up the pieces and start all over again. You must make sure to put in extra effort to rebuild the love and affection again and dis go fit come back if you don make up your mind to dey committed to the relationship again.

*   Forgive and move on.
Now wey you don decide to dey committed, forgive yoursef and your partner for the pain wey he/she don cause you, becos if you continue to hold onto wetin don happen wey cause the break up, dis go make the relationship dey worst dan before.

*   Change yoursef.
The truth be sey no mata how you try, you no go fit change your partner-- na yoursef you go fit change. So focus on how to change yoursef for good and change the issues wey been make una fall apart before. For example, if you no dey respect your partner or you dey take am for granted or you stop to dey appreciate am, maybe through your words or actions, then na time for you to change those attitude for good so dat the relationship go fit work again.

*   Communicate with your partner.
After you don follow these steps wey I don yan, your partner go  see sey true true you want change for good and this go make your partner dey open again to communucate things with you about the relationship and abeg, take note sey during the conversation, no forget to tell your partner how much you love, care , miss and need am back into your life and how important he/she mean to you, and also why you want make dis relationshup work out for good. Give the relationship time  and make una take things small small, you know, one step at a time.

*   If you come notice sey una last discussion before una break up no too go well or becos tension dey between una, write letter or send email o! Dis go allow you talk wetin dey your mind without comma.

*   Accept where you dey at fault as NOBODY dey 100% perfect. Maybe you been dey talk to your partner anyhow or disrespect am when you dey para. Say you dey sorry and make you mean am and show am for your actions too.

SELAH!





Photo credit:   Evan Marc Katz


No comments:

Post a Comment