Wednesday, 24 May 2017

Online Dating: The Good and The Bad






 
Technology don really helep pipul ministry to move forward when e come to dating level between man and woman.Yes, e don make am dey possible for two pipul wey no know each oda and wey be sey dem no ever dream of to get the opportunity to even yan with each oda in pesin to come know demsef, but as life be, for evri good side of something, the bad side go must dey too. So, I go first of all chook eye put for the good side of to date pesin online bifor I begin yan about the bad side too wey be sey pipul go need to dey careful about.




THE GOOD SIDE OF ONLINE DATING


*    Online dating don make am dey possible for pipul to date each oda based on the same interests wey dem dey share or based on their personality. When you date online, you get chance to get to know the oda pesin opinions and wetin the pesin like first very easily unlike when una meet unasef face to face at first.


*    For some pipul wey be sey dem dey dey shy or dem no be the kain pesin wey be the outgoing type, to date online dey also helep their ministry becos dem go get to chat with the pesin freely unlike when dem meet each oda face to face wey go fit make things dey one kain or hard for dem to yan their feelings and wetin dem dey think. And if the oda pesin no too enjoy him/her parole, the advantage for the shy pesin be sey dem no go need to see each oda face to face to end the dating. Na to just say 'Thank you for the chat' and log off.


*    To date online go expose you to meet different kinds of pipul wey you never dream of to meet for your life bifor, and if you dey lucky, you fit find yoursef dey hook up with pesin wey you dey desire for relationship.


*    You no need to leave your house to go meet somebody wey you just enter new relationship with and na free to even chat with the pesin online as long as you get plenty data.


*     Nobody dey put restriction on age, gender, where you come from, how you look, whether you get korrect leg or body or not,etc..


*     Online dating go also give you time to think of wetin to talk and the answer to give the oda pesin when una start to dey chat.



THE BAD SIDE OF ONLINE DATING



*    Dating online dey make am dey possible for pipul to lie very easily about demsef. Sometimes, the pesin fit yan you things about himsef/hersef wey he/she no be for real life. He/she fit yan sey him/she be 6 fit tall, he dey live for Obodo Oyibo and dem go even put pictures wey go make am look the same with wetin dem don yan you online. You need to dey extra careful on the first date wey una go meet. Nothing dey bad to meet somebody wey you like online but when you go meet the pesin, abeg always meet the pesin for public places like Park, Fast Food area, etc.


*    Make sure sey you yan your paddies or somebody wey dey close to you inside your family where you go dey with the pesin and once in a while update the pesin about wetin dey happen, even if na text message, send am to dat friend or family member and also take note of your surroundings too. If the pesin wey you dey date online begin say make una go for somewhere wey dey 'private' wey pipul no too dey and you no dey comfortable about the suggestion, then let am know sey you need to begin go house. No ever try to put yoursef for any danger all becos you want dey polite.


*     The Distance
You fit meet somebody wey totori you well well online and the pesin really dey enjoy your parole and you like to yan more with the pesin but you come find out sey the pesin no dey live for your area or even the state or country wey you dey sef, I tell you, you go need to really think am well well if you really want enter this long distance relationship abi whether e worth am at all when you never meet this guy or babe in pesin bifor. And sometimes, e fit dey hard to meet each oda face to face becos of the cost of money to take dey move from one place to anoda to go see the oda pesin.


*     Incompatibility na when two pipul no fit live togeda.
To make up your mind on somebody wey you don meet and dey date online whether e go be the best choice of partner for you dey dey hard becos to meet and date dat pesin online wey you like na one thing, to meet the pesin face to face and still like the pesin na anoda thing. Maybe for chatting level online, e dey easy to yan with each oda well well and the talk dey flow but when una come see each oda face to face, na anoda tori be dat. So becos una dey flow online no mean sey una go come collabo easily when una see each oda and try to continue for real life.


*     Some pipul fit just talk wetin you want hear and no be wetin dey their mind, so this one fit bring dishonesty. Some fit don marry or even dey serious relationship with anoda pesin but dem go just pretend. Like so like so, but the koko be sey if you want date online, shine your eyes and add prayer join becos e don get pipul wey e work for and e still get pipul wey e no work for.























No comments:

Post a Comment