YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Wednesday, 3 July 2019
Behaviour Wey Fit Scatter Relationship If You Don Be Careful!
My over-kajad pipul wey too gbasky, I don show face today o! Oh boy iiiieeee! E don tey o! Make una no worry. Dis one wey I don show face for blogging tinz, na forward ever titilailai.
Ehen! The mata wey I carry come una domot today na the one wey concern 'our BEHAVIOUR' for inside our relationship. Hmmm... This one na ogbonge I tell you.
As good behaviour dey wey dey make relationship totoricious for pesin heart, na so bad behaiour dey too wey fit scatter relationship and make am look like say the relationship no make any sense.
So make una see some chinkili behaviour wey be sey if fit make make relationship wey been dey seet come get K-leg or make U-turn:
1. When You Begin Do Like Sey You Still Dey Single:
Abeg na how many people suppose dey inside relationship? Shey no be two pipul wey gree to love each other forever? So na which one come be the one wey you dey act like sey na only yoursef? If you know sey you no ready enter relationship, abeg no begin play with pesin pikin like table tennis. If you want want dey inside the relationship, then behave yoursef and make una behave like one couple. No be sey your mind dey for single mode and you still want enjoy the tinz wey pipul wey dey correct relationship dey enjoy. E no fit work.
2. When You Begin Think Of Only Yoursef When E Come To Money Matter:
The minute you begin spend money alone without sey your otepu/bobo no know, then you never start correct relationship be dat. You still be single pesin for inside your mind and forget dat tin wey dem dey yarn sey my moni na my moni and your moni na our moni. Afiah! Dat relationship no go last as money mata for relationship na the koko.
3. When You Too Worry Weda Your Pesin Dey Korlobi Anoda Pesin:
In short, na dis one be the konk gateway to hypertension. And if you dey this level, na sorry be your name. If your pesin no dey give you sign sey him/shim dey cheat on you, abeg leave dog pikin to sleep and you go also make sure sey no be becos of wetin don happen for your bifor bifor relationship naim dey also make you think weda your bobo/otepu dey korlobi anoda pesin for your back.
4. When You Dey Dey Ontop Phone 24/7
Dis one na anoda level to take scatter relationship wey been dey go next level. Na good tin sey phone and oda tekinology waka come, but e go good sef if you use sense follow am too make e for no go pour san-san for your garri. Make una continue to do all those tinz wey una been dey do bifor tekinology show face.
5. If The Face Of Your Bobo/Otepu No Dey Ginja You Again Like Bifor
Dis one na serious gbege o! If those tinz wey him/she been dey do wey dey scatter the dada for your head no come dey ginja your swagger again, naim be sey relationship no dey again. Na make we just dey do tinz so dat pipul dem no go chook eye for our mata level be dat. This kind behaviour no go move the relationship go permanent site if una no siddon talk about am.
6. If You Begin Dey Behave Anyhow
If you no happy abi you dey vex for something, to begin bone your bobo/otepu no be the answer o! E go better make you kukuma yarn your partina wetin dey becos dat parole of to begin bone am no go helep mata at all. Abi to begin chop chop anyhow or spend money anyhow so dat the mata go comot for your mind no go work. Rub mind with partina unto wetrin dey make you para. And if na wetin your partina do, then make you still let am know about am.
7. When You Begin Turn Yoursef To Mario or Monitoring Spirit
Dis one no be am at all. Shebi bifor you and you bobo or otepu know unasef, shebi you dey live your life and do tinz with your life bifor dem enter your life abi? So which one come be the mario wey you want turn to onntop your partina neck. Abeg, e go good if you just free am small and go look for oda tinz wey you go do with your free time. Now, e no mean sey if you spend time with am e no good, wetin I dey try yarn for here be sey make you sef get something wey you dey do with your life and no be only to dey stay with your partina all the time. I tell you e go turn to serious see-finish parole.
8. When Handshake Begin Reach Elbow
Wetin I dey try yarn be sey when joke want become turn to disrespect so the yabbings begin turn to abusive. Na serious bad behaviour be dat. E no mean sey make boo and bae or husband and wife no play or joke with each oda but when the joke don dey turn to abusive like play like play, then una go need to siddon and look into the mata well well again so dat water no go pass garri.
9. Wuruwuru Behaviour
Yes, wuruwuru for inside relationship no go helep the relation grow instead e go scatter everything wey una don build togeda. So e go beta make una just dey honest and true to each oda.
10. Nagging
Hian! Dis one na mama of all the tinz wey I don mention. If una don be cafeful, too much complain go scatter the relationship. So instead of to dy complain and carry the mata for head like gala, why not rub mind with your partina about the mata and if your partina bring any kain mata come to you, make you look into am and also check yoursef well well.
Photo credit: The Black Juice
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment