YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Friday, 28 April 2017
Coming Back Togeda After Break Up
For some pipul, to break up from relationship no be wetin dem want but for some, dem need the break up so dat dem go fit go dia separate ways for good. So my yanning for here na for those pipul wey be sey to break up no be wetin dem want, as hope still dey for una to come back, dat na IF both partners desire to come back togeda o! Oya make we chook eye put for how e fit take happen:
How To Waka With Pesin Wey Dey Dey Moody
Sometimes, you fit notice sey some pipul around you or your friends dey dey moody for no reason and you fit no understand why or how you go take relate with dem. My pipul na serious gbege o!especially when e be sey no be you cause wetin dey make dem feel moody at dat point in time. Shoo! E no dey easy o!but instead wey you go leave dem waka comot or begin quarrel with dem, make you try to do dis things:
Wednesday, 26 April 2017
To Dey Look Popori (attractive) For Your Partner na Koko
When e come to dey look popori , na very important thing for we human beings, both men and women and; for every man and woman wey fall in love with each other, physical attraction na one out of ten things wey make dem date each other. Most times, especially when you don dey too close to your partner or you don enter marriage proper proper, this tendency go dey for you to just relax yoursef and forget yoursef so tey you no go dey worry about your looks again but e no suppose be like dat.
Tuesday, 25 April 2017
Handle disappointment inside your relationship
Every relationship dey get stages and one of dem na when you begin feel disappointment unto sey some things wey you been expect to see inside your relationship or marriage no be wetin you dey see, but you go need to realise sey disappointment after you don get high hopes for the relationship na something wey you need to expect, but e no mean sey all hope don dey lost or sey you no go fit do anything. No! Hope still dey for the relationship to continue. To handle dis disappointment level when e show face, make you:
Subscribe to:
Posts (Atom)