Tuesday, 2 May 2017

Signs Wey Go Show Sey You Dey With Violent Partner






 
Violence na something wey fit happen to anybody inside any relationship, whether the pipul rich abi dem poor ; young or old, tall or short but e go beta for you to notice am quick quick if you don dey date somebody and you come notice dis kain signs, naim be sey na day time you go begin look for black goat bifor night come be dat o!







1.  Put your ear for ground well well when your partner dey talk about himsef/hersef. If you notice sey he/she dey always talk about how e go take whooze somebody slap or beat somebody or break something for pesin head wey dem claim to love bifor or even sey he/she dey make mouth to do dat kain thing to you or anoda pesin, make you be careful with dat pesin.


2.  Watch him/her temper.
Plenty pipul get temper but no be evribody get violent temper.If your partner be the type wey dey shout ontop your head becos of any small thing wey you do, then make you dey careful.


3.  When your partner dey always blame you or other pipul for evrithing wey dey happen to am, make you dey careful.


4.  If your partner dey always drink alcohol too much and take drugs, e dey very possible for am to dey violent especially if he/she no dey fit control the habit of to dey drink or to take drugs. He/she go find am hard to control him/her behaviour when those things wey him/she dey take don take control of him/her brain.Make you dey careful of partners wey dey act in a different way when dem don high.


5.  Over-jealousy and to dey over-controlling plus over-protectiveness na serious mata o when you notice am for your partner character especially when dem no want make you near any of your friends or family members.


6.  When him/her demand don too plenty and you come notice sey dis demands dem no dey make you feel comfortable..

7.  If you dey for boyfriend-girlfriend relationship with dis kain pesin, make you begin use your tongue count your teeth and if una don marry, make una look for help from relationship counsellor so dat una relationship go still dey kajad.






Photo credit:   Online Paddy

No comments:

Post a Comment