YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Wednesday, 3 May 2017
Signs Of Real,Kajad Paddies
E get wetin pipul dey talk sey "If you want get friends, you go need to dey friendly first of all" and na true. Dis signs wey I want yan go helep you to know who your true friend be and also to know how to choose real paddy dem for future.
* Real paddies go take real and genuine interest for wetin you dey do and even dey concerned about the things wey you love and cherish.
* Real paddies dey always give, no be to dey collect,collect and collect evritime or take,take and take alone. Dem dey give too. Weda na money o abi na food, smile, hug, kind words, words wey go encourage you becos evrithing no be only money, even dem go dey pray for you sef.
* Kajad paddies dey dey loyal no mata as things take be. Dem go stand by you when things turn upside down. Jealousy, envy, bitterness and vexation na serious killer of loyalty inside relationship, so kajad paddies dey always try to run from all dis things dem.
* Kajad paddies dey always yan positive things and think of how to move the relationship forward for beta and dem no dey mind to put their lives down for their paddies.
* Kajad paddies dey appreciate the difference for inside oda pipul. Dem no dey compare their friends with oda pipul becos dem know wetin their paddy worth. Naim be sey dem dey value their friendship/relationship well well.
* Kajad friends dey helep each other build their interest up. Dem dey dey connected with the other pesin and understand their paddies enter body sef.
* Kajad friends dey get open mind/heart and dem dey dey honest and real. No fakeness, forming tinz or famzing at all.
* Kajad friends go keep your secrets, defend you even when you no dey there, give you good advice, listen to you and care about you.
* Kajad paddies no go change or turn to chamerlon when other pipul yan negative things about you and dem go share personal things about demsef with you.
* Kajad friends go yan you when you dey wrong and dis trait dey rare dis days becos dem dey say na pesin wey love you or like you well well naim go yan you sey your mouth dey smell. Na so true and real paddies dem be. Dem go yan you as e be.
* Kajad paddies go quarrel with you and still find am inside their heart to forgive you. Dem go overlook una disagreement even after the quantter sef.
I tell you, na good thing to get aleast one REAL, KAJAD paddy!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment