YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Thursday, 4 May 2017
How To Handle Communication Palava Inside Relationship
To dey for inside relationship wey kajad love dey exist na one of the best experience wey you go want be part of and e get sometimes when communication palava go show face for the relationship, but the koko na how una take work things out naim go either make the relationship dey successful or fall apart. And the thing be sey without open communication with each other effectively, relationship go begin dey weak. E dey really take time and work to build up relationship so no be something to rush at all and e dey take both pipul wey dey willing to put in plenty effort if dem want to make the relationship grow.
* E go good for una to dey careful with the words wey una dey use with each oda when quantter come up. If you no dey sure of wetin your partner talk, e go beta if you ask him/her becos sometimes, e dey dey easy to misunderstand wetin he/she don yan.
* Try focus on the palava wey dey ground, no be on how you dey feel. Remember sey pipul dey different and dem dey see things in a different way.
* Make una get open mind towards each oda for inside the relationship. No be make one pesin dey open-minded and the oda pesin go come dey hide hide him/her own mata. Dis go only lead to more communication palava.
* Make una dey honest with each oda and share wetin you dey think with your partner as dis go help the oda pesin to understand who you really be or know you beta. The more the two of una continue to communicate and open up with each oda, this sense of closeness and trust go dey tight fort he relationship.
* When you notice sey your partner dey in a bad mood, no start to dey bring any mata up at dat time becos e fit lead to arguement. Try to yan unasef mata without arguement becos too much of arguement dey block so many things for inside relationship. Make una try to remain calm and respect each oda when una dey discuss.
* Instead of to dey complain about or to your partner ontop evrithing wey he/she do, turn dat complain to request. Instead of to say : "You too like to talk or shout too much or drink, you fit say: "Abeg, you fit reduce the way you dey take talk or drink or shout?" Yan am with respect to avoid arguement.
* No bring up mata wey don pass or happen bifor bifor. Dis dey alway dey common for some relationships. No carry past mata enter present mata. E no go take una anywhere or solve anything. E no dey dey kajad and if you feel sey e get mata from the past wey still dey bother you, make anoda time and day to solve am with your partner but no be at dat moment wey una dey try to solve the mata we dey ground. Timing na koko.
*
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment