Tuesday, 16 May 2017

Why E Dey Kajad To Be Yoursef






 Most of the time, some pipul dey spend almost all their time dey try to form for oda pipul instead of to be demsef; maybe na becos of how dem take bring dem up or becos of the kain job wey dem dey look for or do or e fit be to dey try behave one kain way to take maintain their relationship with anoda pesin, and sometimes, e fit still be sey na to dress or wear one kain cloth so dat dem go fit in or make pipul hail dem sey na dem dey reign--- "Omo, you jaasi" whereas dem dey forget the main reason why dem dey exist wey be to be demsef and funny enough, most pipul no know sey to be demsef dey very easy and simple to practice than to be anoda pesin wey dem no be. Make we chook eye put for reasons why e dey kajad to be yoursef:



*    When you be yoursef, e go helep you get plenty morale to dey confident  and build trust inside you.

*   E go helep you get time to hear oda pipul opinion-- dat is to say wetin pipul go yan and still their yanning no go move you comot from your own opinion.

*   E go helep you to dey kulele with yoursef and with wetin you get, but when you dey try to form for oda pipul, you go want do things wey you no suppose do on a normal day.

*   E go make you get liver no mata wetin you dey face for life and e go helep you find out sey you dey unique; you no be two for this world even if you get twin broda/sista and e go also helep your talent to shine.

*   When you be yoursef, e go bring pipul wey know your value come near your side and the relationship with pipul go last long but if you dey try form for pipul, pipul go still dey attracted to you but when dem later find out who you really be, e go make dem run from you.

*   E go helep you to enjoy the success wey e be sey na you work for am come achieve am becos you maintain the pesin wey you be.

*   E go also helep you reduce the headache of wetin oda pipul dey think or yan about  you becos you be yoursef and no mata how dem run their mouth, e no go stop wetin you go be.

*   You go find out sey to be yoursef all the time go helep you understand the kain pesin wey you be, love the pesin wey you be and even understand your feeling becos na this go make you appreciate and value yoursef.

*   E go still make you dey honest with yoursef and with oda pipul and also make you accept your mistakes when you commit one. E go even make you dey humble sef and more gentle to yoursef.

*   And you know wetin? E go helep you discover your purpose for life and why Baba Godey create you enter world.


NB:   All these koko and jara wey I yan for here na to helep you get kajad morale in yoursef so dat you go fit live life wey get purpose but also remember sey evrithing start and end with YOU; na as you carry yoursef and the value wey you give yoursef naim pipul go take follow you. Begin dey shine!





Photo credit:   Huffington Post


No comments:

Post a Comment