Tuesday, 23 May 2017

Make Your Long-Term Relationship Bubble





 For relationship mata between man and woman, we dey get the short ones wey fit be like 3months, 6months-1year but when the relationship don dey go from 1year to like 2years, 3years, 4,5,6,7years, then the relationship don become long term be dat, and sometimes becos of the stress of the day-to-day palava, dat spark wey been dey make the relationship bubble when una start fit don dey mellow and bifor you know am, we go begin dey hear things like " he no love me again" "she no love me again", "we no love each oda again". So my kajad pipul, naim I say make I yan una how una long-term relationship fit still bubble bifor we begin hear tori wey dey touch the heart!




For here, make we see koko and jara wey go fit helep keep dat spark to make your relationship move on:


1.    Give your relationship attention evritime.
Comot dat idea or belief wey sey once you don enter relationship or marriage, you don arrive, so nothing like to dey worry about the relationship. As long as you dey inside dat ship with your man or woman, you go dey make extra effort to pay evriday attention to your partner and the relationship. Begin dey yan yoursef the truth sey e no easy to stay for long-term relationship, so dat you go fit dey chook eye put for where your relationship need attention.


2.    Pipul wey dey for inside long-term relationship and even marriage sef need to dey date each oda. Why I yan so na becos for this kain relationship to last, una go need to dey do those things wey una do when una just start the relationship; those things wey tototri una back then, make una begin do am. Date each oda all over again. Go out at least even if na once a week. Una need the time togeda to see the beta side of unasef.


3.     Communicate with each oda. 
No wait until e get one quanter wey show face bifor una go begin talk about how you no take dey happy with wetin your partner don do you. Long-term relationship need talk talk evritime and even though you want yan with your partner about wetin dey your mind, talk your mind but also use respect follow am and make the talk talk dey direct, that is to say,straight to the point.


4.     Remember to still be yoursef.
Even though sey long-term relationship need plenty sacrifice from the two of una, e no mean sey you go forget yoursef or hide your identity behind your partner or relationship. Remember sey apart from your partner, you still get your own needs and desires wey fit dey different from your partner own. E fit be sey you love to dance and your partner no like am, dat one no mean sey you go stop to dey enjoy your dancing. Enjoy wetin you and your partner dey do, but still remember to maintain who you be.


5.     Long-term relationship need change.
When I say change, I mean to change swag from time to time. If e get a particular way wey una dey take do somethings, try change am. You fit surprise your partner with new things. Take your partner out, do something wey he/she no expect, buy gift for am for no reason but to put smile for him/her face. Try to keep things onto romantic level. Do sexy things( including the man too o!) Make una take chinkili break one weekend and waka go places like beach, park, play games, rent and watch movies togeda wey go make una laff. Just do something new to dey keep the spark make e dey bubble dey go inside your relationship.


6.      To keep dat spark inside your relationship to dey burn all the time, you go need to do wetin dem dey call 'Compromise', naim be sey you go need to bear some things from your partner as long sey na to the betterment of una relationship. If your partner dey feel sey na only am dey put in more effort for the relationship or give too much and you no dey do the same, then na time for you to start to dey do your own part too. Relationship, whether short-term or long-term, na both partners dey involved, no be only one pesin. Shikena!





 Photo credit:  The Guardian




 

No comments:

Post a Comment