YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Wednesday, 3 May 2017
When Relationship Begin Get Crack
For any relationship, the good days dey and the bad days also dey too. E dey okay to experience the two sides of the relationship but when the bad side of am done come dey plenty pass the good side, then time don reach for you to begin watch out becos anything fit happen wey go begin lead to serious break up.
Plenty signs dey show face when break up for relationship want happen. Some pipul dey see am quick quick amd do something abiut am while some pipul no dey too see am quick quick until e don reach level wey dem no go fit do anything again to take handle am.
1. The first sign be sey interest no go dey there again to contact you. When una start the relationship, the calls go dey flow like kilode and when una dey togeda, no topic wey una no go yan about, even if nothing dey to talk about, both of una go just look for something to talk about even if e no make sense, but when one of the partners don dey tire for the relationship, the first sign be sey the calls go begin reduce. E no go dey come as before again and he/she tell you tell you sey e go call you so so day or time, you no go hear from am, then make you begin watch out especially when he/she call the next day and when you ask am wetin happen , you see sey the explanation no carry weight. If this attitude continue, then make you either see how you go talk to your partner about am or prepare yoursef for the worse.
2. Anoda sign na when he/she no dey pay attention to wetin you dey talk again. E no be like dis when una start, though sometimes, some things fit dey him/her mind wey dey worry am. At dat time, if you mask wetin the palava be and e still get interest for the relationship, e go yan you so dat una go fit find solution to the palava but in cases wey be sey when you dey talk to am and he/she no take wetin you dey talk serious or he/she dey look other pipul instead of you or just come dey occupied with oda things when you dey talk to am, and this attitude come continue deu go, then gbege go soon happen.
3. When he/she no dey make any effort anymore to reach you or even plan for the future with you again. At first when una start the relationship, both of una dey make plans togeda on how una go take like things to be and places wey una go go, how una go take travel togeda, bla bla bla, but when you notice sey your partner no dey even make any effort again to plan the future with again, somethings don dey happen and if una no chook eye put quick quick , break up go happen before you know am.
4. When argument and fight na una way of communication, then make you watch out for break up becos crack go surely show face. Yes, couples dey quarrel but when arguement and fight come pass don't be careful, begin prepare yoursef for the worse.
5. When wetin you dey think of na to break up with your partner at the slightest mistake or quarrel or you begin dey think of life without your partner, then the time don reach to ask yoursef why una even dey inside dat relationship in the first place.
6. When you or your partner no dey HAPPY inside the relationship. Happiness get plenty things to do to make relationships work, but when your relationship no dey make you or your partner happy and dey fulfilled, then watch out o! And when una dey togeda and he/she begin dey dey more silent instead of the talk talk wey una been dey enjoy before, then make you watch out especially when you don try your best to find out wetin dey happen with your partner but he/she no want open up to you.
7. Dis last sign wey I want yan dey very common; no thing wey you go do wey go make am dey satisfied with you. When a man love him woman and when a woman love her man, he/she no go bad-mouth even if he/she add weight or cook food wey dey salty, but when he/she begin find fault for evrithing wey you been dey do wey dey sweet hi/her belle bifor or begin give excuses of how he/she take tire to do something for you wey he/she been dey do bifor, then make you begin look out.
Break up fpr relationship dey harsh but you go really suffer less if you face the facts instead of to hide from the truth. Nobody like make anoda pesin dey cheat on am or even show fake love. so after you don find out these signs and more, and you try to make effort to solve am between una but the oda partner no still show interest again, just remember sey when one door close, anoda beta one go open for suer. E beta make you no love at all than make you dey with somedody wey no love and value you. Get confidence in yoursef sey somebody wey true love yuou go show face one day.
And for those wey don dey inside marriage, make una try seek for counselling becos me no believe sey divorce na the answer when things turn upside down. No palava wey no get solution.
Photo credit : www.pinterest.com
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment