Tuesday, 23 May 2017

You Ready For Mature Relationship?





 Love relationship dey in different ways but all of dem need 'maturity' for dem to last. To start relationship dey very easy but to maintain am to last, na there work dey becos e go need plenty patience, understanding, to comot eye from some mistakes, and to look forward unto the future. 




*   To enter mature relationship, you need to know why you dey go inside first of all. Define your relationship and make your intention known. Most pipul get reasons why dem dey enter relationship. For some pipul, na to just catch fun, for some na make e lead to marriage, but no mata the reason wey make you want enter the relationship, make your intentions clear to the other pesin; come out straight, though sometimes, how you act for the early stages of the relationship fit change or dey different maybe after one or two years. Feelings fit change but to come dey mislead the oda pesin for the early stage of the relationship na immature way to take start relationship.


*    Make commitment to one anoda and stick to am.
Make we face facts, no be all relationship go lead to marriage and anoda thing be sey, most pipul dey get am wrong when dem hear the word 'commitment'. Commitment no be something to make you fear. E mean sey make you dey dedicated to the pesin wey you dey relationship with. Simple. No long tori. Commitment get plenty things to do with honesty, truth and na dis go show if your relationship go come to an end or move to the next level. Even if the relationship no go extend to marriage, at least make am your style to dey committed while the relationship last. If you dey always look for anoda way to cut corners, you no go fit appreciate and build up kajad relationship.


*    Give your partner room to breathe.
Relationship no fit grow well if una no fit dey apart for a while. At least you go go work and your partner go go him/her work. travel, dey with families, friends and na for here trust come in. If you no fit trust someone, you no fit get healthy and mature relationship. Try give your partner benefit of the doubt.


*    To enter mature relationship, to forgive and forget dey very importankpa.
At least if you feel sey you no want do am becos of the other pesin, do am becos of you-- for your own peace of mind. Nothing dey spoil or scatter relationship fast pass when you hold on to the past. To get dat mature relationship, you need to get the spirit of forgiveness. If you don choose to forgive your partner for something and to continue your relationship, then you must put evri oda wrong things behind you and no turn back to am.


*    Chook eye onto the good qualities of your partner instead of the bad ones.
 Most times,we dey dey quick to notice the bad sides of our partners more than the good sides and e dey only take pesin wey get mature mind to comot eye from him/her partner bad sides and put eye for only the good sides. Maybe your partner forget to call you when he/she say he/she go call, guy! babe! abeg e no reach to begin call down thunder and fire. Or maybe na the type wey dey leave him socks for ground when e come back from work or scatter the bed , my pipul, e no reach to begin dey murmur up and down or begin make noise about am even though sey sometimes, e no dey dey easy  to see full-grown man or woman dey do like small pikin sometimes.


*     Know when to let go.
No be all mature relationship go really lead to marriage. If you no dey happy for inside the relationship no mata how mature una try to be to each oda and una don try to see sey e work but e still get comma, e go kajad if you let you partner know so dat una go fit move on with una lives. Dem say "broken engagement beta pass broken marriage". Use your tongue count your teeth.



No comments:

Post a Comment