E don tey wey we don dey hear about dis word wey dem dey call pride. Wetin be dis pride sef? Pride na wen pesin begin feel sey im beta
pass the pesin wey dey next to am, maybe bicos him or shim get one thing wey im feel
sey the oda pesin no get. Pride na the oda side of humbleness.
YOUR NO.1 PIDGIN RELATIONSHIP BLOG PLUS GINJA NEWS AS E DEY HOT !
Thursday, 19 September 2013
Tuesday, 4 June 2013
How to reduce argument for inside relationship
If e get wetin fit make love relationship tire pesin, na argue today,argue tomorrow,argue everyday. E no mean sey two pipul for inside relationship no go argue but wetin I dey try to yan for here be sey if the argument don too much,one or the two partinas go kukuma like am make dem waka go dia separate ways. Na dis one make me want yan una wetin to do for argument to take reduce for inside relationship.
Monday, 3 June 2013
Reasons why some lovers dey fall out of love
Guy: Baby,I love you pass my mama.The love wey I get for you no get part two. The love dey totori me sotey e dey scatter my dada and plait am join sef!Your love dey make me kolo no be small!
Babe: (laff munye-munye) Me too I love you die! Any time wey I see you,,my heart go dey do jigijigi.Your love dey make me kolo! I love you!
When some pipul fall in love,na some of the yannings wey dey enter their mind and mouth be dis. The love go dey totori dem as e dey hot. To fall in love e kajad well well but wetin I want yan for here na wetin dey make pipul fall out of love when dem don enter am.
Tuesday, 7 May 2013
The sharperly ways to take scatter relationship
For dis life,we believe sey everybody get one bad side or bad sides wey gum for dia life and dis bad side fit scatter relationship wey dem dey whether na love relationship, marriage abi na just friends,and if pesin no be careful to watch am,e fit become the pesin lifestyle and dis no go dey kajad at all. Some of the bad sides wey fit spoil pesin blues with reggae na:
Saturday, 4 May 2013
Koko and Jara to take protect your pikins from bad belle people onto illegal torchliting of pikin website
The mata of illegal torchliting of pikin website no be mata wey dey new again as e don turn to everyday parole for the kain world wey we dey now. Dem say 'knowledge na power', so make parents start to dey teach dia pikin wetin to do when dem notice some kain thing wey dey happen around dem.
Thursday, 2 May 2013
Women: Wetin una need to do and no do to una man
Men and women get different ways wey dem dey take yan, different things wey dem need and desire plus different challenges wey dem dey face inside relationship.The way man dey take things dey different from the way woman dey take things and as woman,e get some kain things wey you go need to do and no do if you want make your man dey joli-joli your parole for una relationship as e dey move enter future level.
Wednesday, 1 May 2013
Men: Wetin una need to do and no do to una woman

Sometimes,some men dey complain say dem no know wetin dem go do for dia woman to flow with dem bicos e dey be like sey nothing wey dem dey do wey dey satisfy dem. So na dis make me sey make I write down some of the things wey men go need to do and wetin dem no need to do inside relationship to take satisfy dia woman.
Tuesday, 30 April 2013
Koko and Jara for pipul wey just enter new relationship
When pesin just enter new relationship with a new guy or new babe, e dey shack like stuff as Stan Iyke take talk am and if you no be careful unto how to handle your feelings as e dey do you, you fit begin dey lose dat pesin small small.So therefore make we chook eye put for dis koko and jara wey go help you to maintain the new relationship wey you just enter make you for no miss road.
For guys wey dey shy: Wetin to do to take toast or chaik dat babe to be your otepu *Winks*
For some guys,when e come to the level of toasting or chaiking babe,na serious exam e dey be for them and where water go come pass garri na when the guy himsef na shy pesin. E no dey dey funny at all but as guy,you no need to open eyes for night dey count how many slate dem take do your ceiling again. Make you follow these steps one by each to help your ministry move to permanent site.
Monday, 29 April 2013
How you fit build kajad-closeness with your yori-yori

How you fit comot bitterness from your mind
To carry bitterness for mind na one quick way to kaput comot from dis world and anybody wey dey always carry bitterness for mind no dey ever happy bcos as e never forgive the pesin wey do am wrong,anytime wey e remember the mata,vex go catch am and one thing wey pipul no understand be sey when you carry bitterness for mind bcos of wetin anoda pesin do you,you dey give the pesin power to rule your life.But when you comot bitterness from your mind and allow forgiveness to enter your mind,you go dey joli-joli your life dey go.So for you to fit comot bitterness from your mind sharp sharp,make you chook eye put for dis koko and jara.
Subscribe to:
Posts (Atom)